A woman wey her name na Tracy Williams and dey stay for Ugborikoko, nai police hand don touch as she dey do woman to woman touching with her teree years pikin.
Di tori come out afta di pikin papa go meet police tell dem say he see video where di baby mama dey do lesbianism with dem pikin.
Di Public Relations Officer for di state, SP Bright Edafe, say afta di papa come complain, nai di DPO of Ugborikoko division, CSP Temi Agbede Zuokumor, send men make dem go arrest di motther.
Wey police don arrest Tracy, nai she come say truly her baby dey suck her bress and she get video wey she and di pikin naked, she dey touch di baby kpekus and nor be today tin cus she don start am with di baby wey she dey just 8 months, and make no bodi complain cus na her pikin.
When police come do test for her nai dem see say di small baby don even get sexually transmitted disease and sore dey her vulva.
