One papa, Iseleto, wey dey stay for Osubi community don use dagger take dagger hin 23 years son cud of say di boy go rent anoda haux for di papa wife.
Resin wey make di son Miracle go rent di haux na di way di papa dey beat di step mother, dey wan sleep with her for di children presence and don even try to sleep with di step daughter for di one room wey dem dey stay.
Di young mak come say to create peace from di drunkard papa make di step mother stay alone but di father get evil for mind as he come lure Miracle go one bush on Sunday, use dagger take chuk am many times.
As di papa don chuk Miracle finish nai he run leave am for bush, na struggle he take drag bodi reach road wey pipo see am rush am to hospital.
Na for hospital Miracle come take tok how he papa take deceive am bifor he die. Even di father don call do step daughter tell am wetin he do and still call some family members say he go kill di wife and step daughter cus dem park leave haux and di wife don end marriage.
