Gabon General Brice Oligui Nguema, don say dem don ban all social media for di kontri and nor bodi fit tok anytin.
Na on Tuesday nai Gabon media regulator, say tins wey pipo dey put online dey cus big problem for di kontri nai make dem wan ban social media till futher notice.
Di High Authority for Communication (HAC) tokpesin, Jean-Claude Mendome, nai say di main resin for di ban na cyberbullying, bad mouth and showing personal data wey nor suppose show online.
Dem never tok exactly weda na WhatsApp, Facebook or TikTok wey pipo sey use pass for di kontri nai dem wan ban.
