Police don see one place for Adheje community wey dey along Sapele-Warri road, where criminal take dey hide dem tools wey dem take dey terrorize pipo for di area.
On Friday nai Delta State Police Public Relations Officer, SP Bright Edafe, take tok say di DPO of Orerokpe special operatives nai catch 25 years Dafiaga Timothy, wey dey stay for Effurun Community.
Na di Command Special Assignment Team (CP-SAT), wey ASP Julius Robinson lead nai hand take touch Dafiaga as strong tin touch he body nai he confess come go show police dem hide out.
As police dey find around dem see one long gun, one small gum, one Beretta pistol wey hand do buf s get five bullets inside, anoda ten bullet for ground and one dagger.
