Di 416 pesin wey Boko Haram tiff for Borno State dem bin don ask for ransom but as di moni neva come nai dem give FG two days to produce di mobi or dem go share di pipo go different location.
Na for video nai Boko take dey send dem message with di tokpesin wey dey speak Hausa, say dem be Jama’atu Ahlis-Sunna Lidwatu Wal-Jihad and dem dey under Imam Abu.
Dem come tell Borno South Youth Alliance (BOSYA) and Nigerian government, say dem go soon start to kill di women and shidren.
As Boko Haram drop di video nai BOSYA come out dey beg say make govimet, stakeholders pipo wey get moni come epp bifor di terrorsist go kill di 416 pipo.
