HRM King, Apostle Chibuzor Gift Chinyere, general overseer of Omega Power Ministry (OPM), don put stop to di plan marriage of he 21 years dauta wey get small shaking for head cus more than 1000 men nai apply for di position.
Na two days back nai di pastor king come out with packages say make able bodi man come marry di pikin as she fit dey hear and tok, her own nor be like Aboy own wey nor dey hear and any man weh go marry di girl he nor go sufa for life hagain.
As men hear package naso dem start to apply, as Chinyere see say di tin don pass wetin he expect nai he pause di marriage plan fess, say he go tok about am later as di pipo wey apply too much.
