Police don start to find di passengers wey kidnapa tiff for inside GUO Motors bus wey dey travel dey go lagos along Lagos-Benin Express road on Saturday.
Di kidnap hapen for Iguobazuwa area around 6:00 for evelin and na only five pesin dey inside di bus dat time, dem kill di driver and one woman gun touch her but she dey hospital for treatment.
Di PPRO of Edo State, ASP Eno Ikoedem, tok on Tuesday say di CP of di state, Monday Agbonika don say make na kolabo force and dem go check Ore-Benin bush to make sure say di pipo come out from kidnapa hand.
Di video of di kidnap GUO motor fess come out online as di pesin wey dey video say di kinapa dey shoot di driver and karey di passengers enta bush.
