Kimberly Daniels, wey be US Democratic member for Florida House of Representatives, District 14, don say Nigeria Minister of State for Defence, Bello Matawalle, dey try to bribe one US official to change report habat kristain kpai for Nigeria.
Di US lawmaker don bin tok bifor say make Presido Tinubu sack Matawalle cus he hand nor klean. Na Daniels, be di chairman of United World Congress of Diplomats (UN-WCD) wey dey look into kristain kilin for Nigeria.
For her Facebook nai she put video say Matawalle hand nor klean habat kilin wey dey hapun for Nigeria cus he try to use moni take kwayiete one US official so dat dem go change report of di kpai of kristain but Daniels say she nor go gree and notin anybodi go do to stop her make she nor tok.
Matawalle neva tok weda na true or na lie di US lawmaker dey tok.
