Actor Yul Edochie wey dey do politics work join and na President Tinubu suporta say make Peter Obi nor boda to be president as he nor go fit even as he don still join ADC.
For Yul X post nai he take say any political party wey Obi join must scata and wetin he dey do with ADC nor go work cus na spiritual problem dey follow Obi.
He say he dey shock am say Obi nor know or may be he nor but dey do like say he no koncern am. But di truth be say Obi nor go fit rule Nigeria now.
Yul say Obi na bad luck and any party wey he join instead of dem to go up, just by Obi dey there na down dem go dey go.
