+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Uganda Don Catch Pipo Wey Nor Get Paper To Stay and Nigerian Join

Uganda don start to dey porchu pipo wey nor get paper and dem Ministry if Internal Affairs don catch 231pesin, 62 na Nigerians.

Di pipo wey plenty pass na Ghana, Sri Lanka, Pakistan, Bangladesh, India, Myanmar, Ethiopia, Cambodia, and Malaysia nai dey stay and work without paper.

Na different place for Kampala dem take arrest all of dem on April 27, 2026, afta di kontri pipo don tell di Directorate of Citizenship and Immigration Control say di pipo nor get paper and dey misbehave.

Tokpesin of di immigration ministry, Simon Peter Mundeyi, say some of di Nigerian pipo lie say na word of God dem come preach but dem turn am to anoda tin, some say dem lie give dem say dem dey come work for Uganda, while di oda dey korokoro do yahoo.

Di govimet come dey tell any landlord wen wan rent haux for outsider must ask for paper and dose wey dem don catch go face di law of Uganda.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM