Di President of South Africa, Cyril Ramaphosa, don tell all pipo wey be black and Nigeria say make dem respect di law and tradition of di land cus dem own pipo nor go behave anyhow for anoda pesin kontri.
He say even thou say South Africa dey follow global law dem nor go look back to make sure say any pesin wey nor get paper and dey behave anyhow, dem go chase am komot.
Na for SABC News on Freedom Day, nai di president take tok so as di wahala between South Africa and oda black pipo dey increase.
But as di wahala dey on, di Nigerian Acting Ambassador to South Africa, Alexander Ajayi, tok for interview say make Nigeria pipo nor dey fear cus dem dey try to kontrol tins.
