+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Unkown Pesin Kpai Student Nurse For Imo

Di students wey dey for college of Nursing for Umulogho, inside Obowo Local Govinet for Imo State dey cry cus one of dem student wey be Wendy Achumba nai bad pipo don kpai on Thursday.

Wendy na student wey don finish her midwifery but dey do her post-basic training, bifor di bad men go cut her head komot from her bodi for her haux outside skool. Wey police reach di place dem see wetin hapun, come karey her bodi go mortuary.

Di tokpesin of Imo State Command, Henry Okoye, confam di mata and say dem don katch one pesin but still deg ask kwestun to know who kpai di nurse and why.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM