Oyo State govimet say di tori wey dey fly sag dem don free di teachers and skool shidren wey bandits kidnap for Oriire LGA no be true.
On Wednesday nai di video start to trend online say di shidren and teachers don come out but di Special Adviser on Security to Govinor Seyi Makinde, Abayomi Fagbenro, nai sau di news na lie as dem still dey find how to free di pipo.
Since last week friday wey di bandits tiff di students and teachers dem never still see light even with di police wey Inspector-General of Police, Tunji Disu, say dem send to go join hand fight for di shidren and teachers release.
