Anoda kidnap don hapun for Ibadan afta more than two weeks wey bandits tiff skool shidren and teachers for Oriire LGA, dis morning dem don tiff mama and her 2 shidren for Ibadan South LGA.
Di Video wey dey online show say na di foma Minister of Pawaa Adebayo Adelabu, wey resign cus he wan be govinor for Oyo State under APC but dem still win am for di primary, na he small sista and her two boys nai dem tiff so.
For statement nai dem confam say na di sista, Mrs. Busayo Adegoke John-Paul wey be 43 nai really lost as she dey karey her 12 years old twins Peter and Paul go skool around 7:30 for morning.
Mrs. John-Paul nai be di last pikin of dem Adelabu haux and as he be naw, nobodi know where di kidnapa put her and di shidren.
