David Adeleke, aka Davido, don karey wetin dey hapun for Oyo State and Nigeria insecurity go show for FIFA World Cup countdown, say make dem free di skool shidren and teachers.
Di singer wear one black jacket wey get green buttons, and inside na di names of all di skool shidren and teachers wey still dey alive na white dem take write am but di ones wey din kpuf dem write am with red for di green button.
Davido say dem nor fit keep kwayet for wetin dey hapun cus anywhere dem get to speak about am. Even di white shirt he wear dem write “Nigeria” inside den di back of di jacket dem write,”Bring them home.”
