+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Be Diabetic Kpuf My Papa For Kidnapa Den- General Son

Di family of foma tokpesin of Nigerian Army, late Major General Rabe Abubakar (rtd), wey kpeme inside where bandits hold am since, don say wetin di Katsina state govimet dey tok say na diabetics nai kill dem papa na big lie cus dem papa nor get di sickness bifor.

Na for May 30 nai kidnapa take tiff di General and hin wife along Marabar- Musawa road
for Katsina, but di man wife still dey with di kidnapa even afta di general don kpuf.

Na one of di pikin of di general, Isyaka Rabe, nai tok for interview say say wetin di state govimet dey tok about hin papa get diabetic and hypertension nor koret, while some oda pipo dey say e fit be say na snake bite di general cus of di place wey dem dey.

As tori pesin ask am how dem take dey he papa dead bodi nai Isyaka say he nor know, make dem ho ask di state govimet cus na dem bring di bosi while di mama still dey with di kidnapa.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM