No be smal shock nai enta pipo bodi wey dey stay for Ekuigbo kominiti for Ughelli afta one young woman go kpai her two days old baby wey she just born.
Tori get am say area come dey wonda where di baby dey but di woman come lie say she don give di baby to her friend but di story come dey get plenty mouth with too many kwestun.
Na den one pesin say he see her for nite with di baby wey she karey go uncompleted building. As dem dey ask her nai she confess say she don bury di pikin alive, come karey dem go where di deadi bodi dey for di building.
Police never tok on di mata as investigation still dey on but di area pipo don dump her for station
The police command are yet to make statement concerning the incident but she is currently detained for futher investigation.
