Di Prime Minister of United Kingdom Keir Starmer don say he nor dey work hagain and ready to give di position to any pesin wey wan sitdon for di sit.
Dis na even bifor two years wey Starmer don stay as di Prime Minister for di kontri under Labour Party. But tension don dey grow and approval rate dey drop nai make he sack hinsef.
For di speech wey Starmer dey tok on Monday for front of 10 Dowing Street on Monday, he face be like who wan cry but he say as di Labour Party dey ready to choose dem new PM on July he go wait till den but make dem know say ge don step down.
Starmer say why he komot as PM na cus he get UK for mind and no fit sitdon look.
