Di seat wey Hon. Collins Egbetamah dey sitdon for House of Assembly as Udu Constituency lawmaker don dey open afta he shift from APC to NDC.
Na for April 30 nai Egbetamah say he nor do hagain but on June 19 nai he write di letter wey Speaker of di House, Emomotimi Guwo, come read to all di lawmakers and as e don be di constitution nor allow dat kind movement wey pesin tenure never finish. So dem don send message to INEC say di seat don dey open.
Na all of dem for di Assembly nai gree for di motion on Tuesday afta Majority Leader, Emeka Nwaobi bring am out den Deputy Speaker, Arthur Akpowowo come second am and na him even chair di session.
