+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Tell Sojas No Come Or Dem Go Kpai Oyo Skool Shidren – Defence Minister

E don reach 2months and still dey count wey bandits go tiff 39 shidren and seven teachers from teree skool for Yawota and Ensinle, all of dem for Oriire LGA wry dey for Oyo State, but military dey say dem hand tight as di kidnapa say make dem free some of dem oga wey harmee hares.

Na for News Central on Wednesday nai di Minister of Defence Christopher Musa take say dem dey go di place wey di terrosists hide but dem get to stop cus di bandits say if dem come close, all di shidren and teachers go kpai.

He say soja bin don hares some of di terrosists commanders now dem dey use di shidren and teachers as ransom to free di commanders but if tosay di law of di kontri dey strong pipo for dey know how dem dey behave but as he soft, anybodi fit waka ontop.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM