+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Notin Beta Hapun To Peter Obi – Atiku Warn FG

Atiku Abubakar don dey warn FG say make dem behave well cus if dem opress one opposition na everybodi e touch. Dis na cus of wetin Peter Obi tok say govimet dey afta hin life.

He say di ADC presidential candidate get right to dey free for hin kontri and govimet nor suppose use power take dey opress di ones wey nor dey for power.

Na for inside long letter wey Atiku di NDC presidential candidate send hin Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, to write nai di gist dey.

But part of di letter, “Notin must hapun to Peter Obi. If you shuk hand for one pesin eye, you don shuk hand for everybodi eye. Wey dem don dey supres one oposition voice di same music go sing reach di odas. If one pesin don dey fear cus of politics nai be say democracy don dey craze.”

Atiku say wetin dey do di kontri like hunger, poverty, corruption, kidnaping dem neva face am na to dey fight pipo wey dey tok hagais dem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM