+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Flood Don Kpai 9years Boy For Asaba

Wey pipo dey complain say di gutter wey dey for Asaba dem supose use sumtin cover am a make e dey safe for pipo especially wey rain dey fall, di case don bad now as one 9 years boy wey be Chukwuemeka Emmanuel, water don karey am from Redeem Junction for Okpanam Road go anoda side afta heavy rain wey fall.

Na Monday nai Harrison Gwamnishu bring di boy kase say dem dey find am, so make pipo wey dey stay for Anwai Road check dem gutter weda dem go see di boy.

But on Tuesday, August 4, Gwamnishu come say dem don see di pikin inside di flood water for near Asaba International Airport but wey dem karey reach hospital, dokitor say he don already kpai.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM