Police don stop one Jeremiah Kwane wey be 26 years and dey try to wan go kidnap one pastor and retired skool principal for Ughelli.
Everything hapun on July 31 wey A Division for Ughelli get information say Jeremiah dey plan to wan go tiff di pastor and he dey employ pipo wey go folow am do di job.
Naso di police reach where he take dey work, hares am, come dey do search nai dem see one single-barrel gun with two live cartridge
Delta State Police Spokesperson Bright Edafe say dem get Jeremiah for dem custody and dey do investigation on di mata.
