+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Davido Don Dig Out Gov Okpebholo WAEC Result Afta He Yab Gov Adeleke

No be small yab nai Osun State Govinor, Ademola Adeleke, kolet from Edo State Govinor wey he dey tell pipo make dem chop he moni but nor vote for am cus only dance be di tin wey Adeleke sabi for life and nor know wetin dey hapun around am.

Govinor Monday Okpebholo say bifor pesin go sign paper, he go dance. Una never tire? Dis na wetin he dey do for four years now. Bifor dis man go chop he go dance.

He come still say “Bifor he enta plan he go dance. By di time he reach we don already finish and nor go know wetin sup. If dem give una moni, chop am but not vote for dem.

Hours afta di video go viral nai singer David Adeleke wey be di nephew of Govinor Adeleke come go find di WAEC result of Gov Monday Okpebholo post online.

He nor write anytin put but di result of Okpebholo show say he get D7 for Commerce, Christian Religious Knowledge, Economics, and English Language; then E8 for Govimet; and C5 for Mathematics.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM