Reports wen reach us dis weekend na say Naija go fit spend around $576 million to take get COVID-19 vaccine.
Director of National Primary Healthcare Development Agency (NPHDA) Dr. Faisal Shuaib come talk say the government dey plan to immunise 70 per cent of Nigerians wen dey at risk of the virus.
According to am, the Global Alliance for Vaccine and Immunisation (GAVI) go make free vaccine wen dem go take immunise 20 per cent of those wen dem wan vaccinate available to the country and 91 other countries.