Lucky Aiyedatiwa wey be di Deputy Govinor for Ondo State don enta enta as di nuba one man of di state afta Govinor Rotimi Akeredolu just die today Wednesday.
Na for Cocoa Conference Hall inside di Govinor office nai di Chief judge of di state, Justice Olusegun Odosola take swear Aiyedatiwa in as di new Govinor.
Na high pipo for govimet and senior men wey be judges nai dey for di ceremony of di new govinor.
Remember say na today Wednesday nai news come out say cancer of di blood and prostate nai kill Givinor Akeredolu.
[SA]