+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Judge Don Swear Deputy Govinor Aiyedatiwa As Ondo Gov

Lucky Aiyedatiwa wey be di Deputy Govinor for Ondo State don enta enta as di nuba one man of di state afta Govinor Rotimi Akeredolu just die today Wednesday.

Na for Cocoa Conference Hall inside di Govinor office nai di Chief judge of di state, Justice Olusegun Odosola take swear Aiyedatiwa in as di new Govinor.

Na high pipo for govimet and senior men wey be judges nai dey for di ceremony of di new govinor.

Remember say na today Wednesday nai news come out say cancer of di blood and prostate nai kill  Givinor Akeredolu.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM