+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Actor Junior Pope Don Really Die

39-year-old actor, Junior Pope Odonwodo wey pipo know as Junior Pope don las las die.

Na for inside River Niger nai di actor die yesterday afternoon wey dem dey do one film for Asaba but dem rush am to hospital and he still die.

Wetin tori yarn be say Junior Pope and two other actors nai die wey di boat dey try to cross from Anam River wey dey for Anambra State to Asaba.

As pipo drag dem bodi out from di water, small pulse still dey he bodi but as dem rush am go hospital dem try but di actor still die.

Confirmation from the Chairman for Delta State Actors Guild of Nigeria, Emma Onyemeziem, don confam say di actor don die leave he wife and teree boys.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM