+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Akpabio Jejely Resign As Senate President – NADECO

National Democratic Coalition (NADECO) for United States of America say make Senator Godswill Akpabio resign komot as di senate president cus hin nor dey behave and handle tins well as a president.

Di coalition say na President Bola Tinubu nai plant Akpabio as Senate President and Akpabio now don dey use am rob hin colleagues so that dem nor fit dey know dem work again.

For statement wey di Executive Director of NADECO for USA, write on Tuesday, Mr Lloyd Ukwu say Akpabio nor dey folow di rules wey Senate don already set for ground to luk bills well, debate well for dem plenary meeting and other tins wey nor join.

Nai Ukwu say make Nigerian Senators use koboko take pursue Akpabio komot as Senate President.

He say, “You don turn di upper chamber to where dem take dey laugh and play cus of your small pikin way, wey wan favour di executive and nor even dey resin di out come.

“Na Akpabio way to always kip anytin wey president tell am instead of am to tok am with di house, just like di one wey he do to announce di three new minister wey president appoint.

“E never too tay wey di Chief Whip of Senate, Senator Mohammed Ali Ndume (APC, Borno South) and Senator Mohammed Ogoshi Onawo (SDP,  Nasarawa South) come out to accuse Akpabio say hin nor dey give senators enough time to debate, put full eye for bill especially monie own, nai dem dey warn make anoda kasala nor go happen.

Ukwu say if Akpabio nor gree komot or Senators nor pursue am, NADECO for USA and dem members plus other Nigeria pipo wey dey obodo oyibo, go protest to drive Akpabio komot from seat as Senate President.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM