+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Akwa-Ibom Man Kill Hin 70 Years Mama

One man Inyangake James Peter don land for police hand afta he kill him 70 years mama wey be Mma-Offiong James Peter for inside Akwa-Ibom State.

Inyangake na 40 years and on April 4, 2024, around  9:00 for morning nai police arrest am for Etim Ekpo LGA as he go kill e mama afta one voice send am to kill her.

Police statement wey di Public Relations Officer, Odiko Macdon, tok on Monday say na for dem village for Ikpe Annang inside Etim Ekpo nai everytin take hapun.

Wey police dey ask Inyangake why he kill him mama, he say na one voice dey shout for him head to kill di mother.

He nor fit hold am again nai he folow di voice scatter di mama for ground.

Police don send am to state Criminal Investigation Department, CID, make dem do beta investigation on di mata.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM