+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Amaechi inaugurate committee to probe NPA boss

 

Rotimi Amaechi, d minister on top transportation, on Monday inaugurate one 11-member investigative panel to probe the Nigerian Ports Authority (NPA) as regards all d contracts wen dem don award since 2016 when Hadiza Bala Usman take become Managing director.

You go remember say na on Thursday nia President Muhammadu Buhari take suspend Bala Usman as Managing director of NPA den he come give pass mark for the setting up of one panel of inquiry based on wetin Amaechi recommend.

Even as Bala Usman dey deny the allegation wen dey play say she no tender money wen dey under her care, she come talk say dis one wen dem dey say d NPA fail to submit outstanding balance of N165.32 billion from 2017 go reach 2018 na misrepresentation of facts.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM