Independent National Electoral Commission don tok put for di post wey come out habat dem Chairmo Joash Amupitan, as di ICT director, Lawrence Bayode, say dem nor resin wetin AI dey tok cus sumtime AI dey do anyhow.
Gbege start afta di post wey Amupitan write for X come back. He tok say “Today I dey hapi, nor be only say i give my polling unit, but win 7 of di 10 polling units wey dey for my area wey Igbo pipo full and APC neva win there bifor.. i sitdon with di youyh for di komuniti to form strong hold.”
Opposition say a pesin wey hand dey politics dey behave like dat and make di INEC chair komot from di position. But INEC say na big lie notin like dat hapun.
Dem say Amupitan nor get any X hakant and security don dey work to know who dey use he name take do post for social media.
