Udo-ga-achi security for Anambra State don hares Chidozie Onyenka cus he cut hin papa throat and di gbola for Amaigbo inside Nanka on Thursday.
Chidozie say hin mama bin karey am go meet one man for Oke-ite to do ritual, di prophet come tell am to bring human part. Since he nor get he use N200k take pay and since dem di prophet dey work for am. But on dat Thursday, he ask di papa to give am di balance from hin machine sales afta di papa don bail am but di papa kareg knife say he go chuk di son.
Chidozie come take di knife from di papa cut hin throat, na with di epp hin friend Chidiebere Ohakari, wey don run nai he take cut di oap
Afta he don cut di papa gbola finish, he come troway am for Ududo-Nanka, stay there small bifor he start to parabulate till di next morning wey he come tell di sista wetin hapun.
