+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Anoda Nollywood Actor, Zulu Adigwe Don Fall

Anoda cry nai don enta Nollywood again just now wey Junior Pope and some oda actors die inside Anam River for Asaba, actor Zulu Adigwe don die join.

Na on Tuesday nai di death of di actor start to spread online afta one movie producer, Stanley Nwoko write for Instagram say Adigwe don die.

On Wednesday nai di Actors Guild of Nigeria, AGN, National seke, Abubakar Yakubu come confam di death say dem dey wait to hear wetin kill and and di burial plan.

According to tori, dem say na as dem dey road dey go act film with oda actors nai Adigwe take die for location.

Pipo know Adigwe for Nigeria film as pesin wey dey like to act papa part.

Na for Enugu dem born di man but he come travel go Austria to finish him primary and secondary skool.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM