+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Army See 3m Litres Of Crude Oil Inside Rivers

For Rivers State Nigeria army just see 14 different place wey dem take kip over 3 million litres of crude oil for Odagwa Etche wey dey for Etche LGA inside di State.

Na di 6 Division wey Major General Jamal Abdusalam wey dey command 6 Division nai tell tori pipo as hin dey show dem di place say na 49 boilers nai dem see for where dem take dey do di fake refinery.

Army say for di 14 pace wey dem dey kip di oil na over 200,000 litres of oil nai dem see inside.

General say na different tanks nai di pipo construct, use hose and cable take connect am go reach crude oil wellhead wey dem don abandon for di area.

He say, “Why we bring una come na make Nigeria pipo see wetin dey happen. You see say dis place na deep forest. Even if you use helicopter and army drones, you nor go fit see wetin we dey see for ground here. Na base on beta information nai karey use reach dis place.

“We don see many tins here. You dey see di reservoirs wey for take more than 200,000 litres of crude oil. Na 14 We don see inside this bush. Not to tok of di 49 boilers and rin other tins for di area..

“Di crude oil wey dey this place pass di one wey Nigeria dey even sell outside di kontri everyday.  E nor just make sense. If you do di maths of all di oil wey dey here na over 3 million liters. We nor dey tok di one wey dem don already process o, na di one wey we just see be dis.

Abdusalam say dem don arrest some pipo wey dey karey di crude sell but dem never catch di main pipo wey dey inside di business.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM