Popular singer, Innocent Idibia wey e family mata don dey waka for social media afta he say he don divorce him wife Annie Macaulay Idibia wey be he African queen, online inlaws go drag am tay cus new mata dey come up daily. Afta 2face post wetin he post for social media, nai rumour start to waka say di singer dey follow one honorable member cus dem even see di two of dem for Lagos club. But for video wey 2face just release, nai he dey confam say he dey friend Edo State lawmaker, Natasha Osawaru, dis one na afta video come out wey di singer go Edo State House of Assembly wey dem dey do meeting. As e be now 2face don serious to marry Osawaru cus he say she fine and know book, so make pipo nor dey tok say na she be home breaker. Di video he tag am “To Whom It May kwansighn. #I don yarn my truth. Feel free to kwatinue to tik anytin. We go all dey alright. “I don dey see many tins, many pipo dey tok wetin dem nor know afta I lost wetin I post, yes na me post wetin I post. “Una don dey drag Hon. Natasha enta di mata dey call her different kind of names even home destroyer. “But di woman na just young pesin wey karey book for head and know wetin she want but nor get anytin to do with me and Annie marriage. “Yes I love her, she dey amazing, she dey cool, I wan marry her.”
CBN Don Increase ATM Charges From N35 to N100
Central Bank of Nigeria (CBN) say dem don change di charge rate wey dem go dey kolet from ATM cus di last time wey dem change am na for 2019 wey dem karey am from N65 to N35. Na for inside circular wey Acting Director of Financial Policy and Regulation Department, John Onojah sign, nai dem take say di new charges go start from March 1, 2025. CBN say na cus tins don dear for market naj make dem increase ATM charges so that dem too fot dey for business and make banks work well. Different banks get dem charges adh dem dey give bifor as some dey kolet N35, some dey take N50. But as e be now na N100 for N20,000 dem go dey kolet if na same bank ATM and nor go put extra charges but if na another bank N100 den other charges fit dey reach like N450.
Supreme Court Throway Gov Fubara Case Against 27 Wike Lawmakers
Supreme Court don troway di case wey Govinor, Siminalayi Fubara bring to comot 27 members of di State House of Assembly cus dem comot from PDP go join APC. Di Court wey Justice Musa Uwani-Aba-Aji judge on Monday nai tell Fubara lawyer, Yusug Ali, SAN, say make dem go sitdon one side. Na Govinor Fubara nai first say he nor want di case again bifor di teree man panel cus water don swelup for di case and even di Rivers State House of Assembly and di Speaker, Martin Amaewhule, wey dem lawyer Chief Wole Olanipekun SAN represent dem gree. As all parties involve for di case gree to karey mata from court naso court say make Fubara pay 4million naira to di House of Assembly and Amaewhule.
Rep Members Wan Create Warri State With Oda States
E don dey clear say fight dey for Warri to know who be di real owner of di city, while some don kukuma turn one part to Wado City, na all dis move make di House of Representatives Committee for planning say dem wan create new state and Warri State na one of dem. Di House Constitution Review Committe nai say dem wan create new 31 states join to di 36 states wey don already bin dey and na di Deputy Speaker, Benjamin Kalu nai read am. Di names of di new states na Okun State, Okura State, and Confluence State from Kogi; Benue Ala and Apa States from Benue; FCT State; Amana State from Adamawa; Katagum from Bauchi State; Savannah State from Borno; and Muri State from Taraba. Odas na New Kaduna State and Gujarat State from Kaduna State; Tiga and Ari from Kano; Kainji from Kebbi State; Etiti and Orashi go be di 6th state for Southeast; Adada from Enugu; and Orlu and Aba from Southeast. Then di remaining na Ogoja from Cross River, Warri from Delta, Ori and Obolo from Rivers, Torumbe from Ondo, Ibadan from Oyo, Lagoon from Lagos, and Ogun, Ijebu from Ogun, and Oke Ogun/Ijesha from Oyo/Ogun/Osun states. Well di committee say dem go look into all but di proposal get to follow di write step of wetin Nigeria constitution tok bifor dem go reason am well.
Dokitors Use YouTube Video Do Operation For Imo Woman Wey Get Belle
Di pesin wey get Lebechi Hospital for Owerri, Imo State, police don arrest am afta dem dokitors use YouTube video deg do CS operation for woman wey wan born. For video wey di late woman husband, Mr Onyekachi Eze post nai there he take explain wetin di dokitors do as dem dey watch di YouTube video dey do di operation for him wife wey get belle. Eze say he karey him wife go hospital wey she dey labor then dokitor come say dem get to do her operation as she don already dey bleed. Naso di female dokitor call anoda dokitor make he come do di operation. But Eze sat for he korokoro eye di dokitors deg watch how dem go take do di operation for YouTube video, na that process di wife and di baby take die. Police Command for Imo State don arrest di owner of di hospital and di nurses but di dokitors wey do di operation don run.
Make Una Come Invest For Delta, Oborevwori Tell Sweden Investors
Delta State Govo, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, dey spin Swedish investors make dem make use of di opportunity wey dem get to take do beta investment for Delta State as di place get enough natural resources. Na wey di Swedish Ambassador to Nigeria, Annika Hahn-Englund, with her pipo come visit Govinor Oborevwori for Govimet House on Tuesday for Asaba nai he take tok so. Oborevwori tell dem sag enough oil and gas dey do state and if dem invest for di state dem go gain am as di two nites wey dem sleep for di state notin hapun to dem. He come dey use sweet words dey tortori di ears of di Sweden pipo, say airport dey for Asaba, Osubi/Warri and Escravos then places like Kwale free trade zone, Koko free trade zone and the Ogwashi-Uku Agro Industrial Park na places wey git benefit too.
No Bodi Fit Komot Me From Sit, Tinubu Warn
Case wey Stanley Okonmah file against President Tinubu and na lawyer Olukoya Ogungbeje nai karey am to Federal High Court say dem wan tell National Assembly to komot President Bola Tinubu for di role he play for di 2024 #Endbadgovernace protest, others don dey challenge am. Na team of lawyers wey Sanusi Musa, SAN, Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Prince Lateef Fagbemi, SAN, and President Tinubu come say di case nor get any stand and no bodi right dey under ground. President Tinubu and AGF say di pesin wey bring case come court just dey fight for pipo wey nor get face and dem nor even tok anytin like say govimet go against dem right but di man karey mata for head like who dey hawk. Govimet say for di protest dem send security pipo to make citizens dey safe make jaguda boys nor go take over di process. Di case na Justice James Omotosho.dey jorjimet am but on Monday, dem come karey am go March 4 so that di lawyer wey dey represent Stanley Okonmah, go fit ansa kwestun wey President Tinubu and AGF dey ask.
M23 Rebels Say Dem No Wan Fight For Goma DRC Again
M23 rebel group wey di kontri of Rwanda dey back to fight Democratic Republic of Congo for di eastern city of Goma say dem nor wan fight again cus of human being sake. Many pipo nai nor get where to stay again since di fight for Goma start and di place na one of di place wey get beta mineral resources bifor dem come annonce on Monday say dem nor wan fight again and di Congolese govimet never talk about am. On Monday nai U.N. tokpesin Stéphane Dujarric tok about how tins dey go for Congo and how health problem don dey rise. According wetin UN refugee agency report tok since di fight start for 2025, more than 400,000 pipo nai no get haux again, 900 don die and 2,880 nai don wound with G7 nations and EU dey condemn why Rwanda go dey enta anoda pesin kontri. But afta di announcement wey di M23 rebels do, di Congolese govimet never put mouth for di mouth.
Killer Kill Teree Children, Put Dem For Freezer
One craze wey dem never know who di pesin be don go kill teree children wey dem papa and mama leave for haux on Saturday for Nnewchi, Nnewi, Anambra State, come put di deadi bodi for freezer. Di children wey dey do man server work for church na The children, 9 years Ejezie Chikaima Davina, 7 years Ejezie Chinziterem Dominica, and 5 years Ejezie Chimdilim David. Dem mama wey be nurse and dey do lecturer work too, nai leave di children fkd haux go write exam on Saturday February 1, 2025, but as she come dem haux door open for ground and normally do children dey lock door if dem dey go play. Na do papa of di children Ejezie Udochukwu Samuel, wey dey work for Irrua, Edo State, nai karey di mata come outside for post about wetin hapun to dem as family. He say according to do wife wey call am on Saturday, say she start to find do children sotay she find dem reach church but nor see dem, until pipo come dey find enta fridge na there dem see di teree children deadi bodi. Police Dom put bodi for di mata as di Police Public Relations Officer for Anambra, SP Tochukwu Ikenga, say dem don start investigation and even karey am to SCID cus di CP say dem must find who kill di children. But small insight wey dem get be say, do pesin kill di children bifor e put dem for di freezer cus food wey dem dey chop just dey for ground.
Pipo Congratulate Tems As She Win 2025 Grammy Award
Singer Temilade Openiyi wey everybodi know as Tems nai don win di 2015 edition of Grammy Award wey dem so on Sunday. Di song wey di Tems take tear everywhere na di “Love me jeje” single and na wetin dust Burna Boy, Chris Brown & Davido, Asake, Yemi Alade, join with plenty odas. As di singer don win di Best African Music Performance naso different pipo dey congratulate her as e nor easy. Even sef Peter Obi foma Govinor of Anambra State don throwaway salute for her and odas, say e nor easy as all of dem dey make Nigeria proud so tay dem karey shoulder like who get boil for armpit.