As Vice President Kashim Shetimma don use word blow Olukemi Badenoch for obodo UK say she nor get respect for kontri wey she come from, she don drop her own wotowoto say na only true be her message. Kemi na di new leader for Conservative Party Leader and bifor then, any small chance she dey tok about di problem wey she face for Nigeria as she dey grow with many tiff and bad tins. Na those her tok come make VP Shetimma say instead of her to dey tom bad about Nigeria anyhow, e go beta make she remove Kemi from her name. But di opposition leadet for UK don tok thru her tokpesin say her work nor be to be Nigeria PA but na to focus on her new leadership role for UK.
Court Don Send 18 years Wey Tiff Agbo To Prison
One Magistrate Court for Jos, Plateau State don sentence Joshua Gowol, to six months prison cus he go tiff agbo mericin. On Wednesday nai di judge of di court Shawomi Bokkos say make di 18 years boy wey dey sell tins go cool off for prison afta he accept say he really tiff di agbo. Joshua bin go break one Mary Michael shop tiff but she come karey di mata go report for Anglo-Jos Police Station on November 18th, wey she see di agbo for Joshua’s hand as she dey go back to haux from work. As police officer Ijuptil Thiawur come take di mata to court nai Magistrate Bokkos say make Joshua go prison for six months or pay N30,000 as fine.
Okuama Treasurer Don Die Afta Presido General Die For Military Cell
Seven days ultimatum wey Okuama community give say make govimet gree dem leaders and di President General of di community deadi bodi wey die for military hand, anoda one don hapun again. E never tay wey Okuama cry come out say Pa James Oghoroko die, Dennis Okugbaye wey be di community treasurer don still die for military hand. No be small fear deg di pipo bodi cus na six days nai back nai PG die and now treasurer dey follow, dem say make President Bola Tinubu and Army ready to finish all di village pipo as dem go really go block di water. As di 81 years man die na di son wey be Pastor Akpos Okugbaye, nai annonce am on Tuesday say he papa don die and still others dey cry for military cell.
Kano Police Arrest Teree With Fake Different Kontri Moni
Teree pipo wey get fake moni wey reach N129,542,826,000 nai police for Kano State don catch join with di pesin wey dem go tiff di fake moni from. Na on Tuesday nai di command take say na total of 3,366,000 US dollars, 51,970,000 francs CFA and 1,443,000 naira. Two of di suspects wey tiff di fake moni join with di pesin wey dem tiff am from dey with police as dem dey do investigation on who dey produce di fake moni. Public Relations Officer, SP Abdullahi Haruna, say nor be only di fake moni dem see as even six live ammunition, teree keke, eight okada, teree parcels wey 175 wraps of dry leaves wey be like higbo dey, 250 diazepam tablets, 278 sheep, and 7 cow. Di tok pesin say tins like kidnap, army robbas, jaguda and pipo wey dey sell drugs don dey run find where dem go hide.
E Betta Make You Change Your Name From Kemi, VP Shetimma Tell Kemi Badenoch
Vice Presido, Kashim Shetimma don say many pipo wey dey japa especially Nigerians dey epp obodo oyibo kontri economy beta. All di plenty tok start wey VP Shetimma dey trow blow for Kemi Bandeco di new Conservative Party leader for UK, as she dey do wan kind dey shift bodi from Nigeria wey she come from. Kemi bin don curse Nigeria leaders for 2022 say dem nor get sense as na only to dey tiff public moni dey use for dem sef nai dem sabi. But on Monday for Abuja during di 10th Annual Migration Dialogue for State House, Shetimma congratulate Kemi but say he nor like di way she dey do, make she kukuma komot di Kemi from her name and face front. Because afta Kemi enta position nai Nigeria Govimet thru di chairman of Nigerians in Diaspora Commission, NIDCOM, send message to Kemi office but till today di woman nor ansa Nigeria.
Obi Visit Aare Afe To Fit Free Dele Farotimi
Foma Govinor of Anambra State, Peter Obi don go visit Dele Farotimi, lawyer wey dey do activist work join as dem arrest am come out am for prison say he dey tok bad against Nigeria judicial system and even curse pesin for he book. On Monday evening nai Obi come still karey hinsef go meet di founder of Afe Babalola University for Ado-Ekiti (ABUAD), Aare Afe Babalola, SAN, for hin office wey dey inside di skool. Normally Farotimi na very strong member of Obidient movement bifor dem arrest am come charge am to magistrate court for Ado-Ekiti last week. Sources say di resin wey make Obi go visit Babalola na cus of Farotimi do that dem fit end di case and na thru one foma Presido nai Obi fit take get di link to see Aare Afe. Court sha don give Farotimi bail of N50m and he go bring pesin wey get reach N50m to stand for am, na those tins he lawyers dey work on.
We don ban sachet alcohol,obey am -NAFDAC
Mojisola Adeyeye, director-general of the National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC), don tell manufacturers and distributors to obey the ban on alcohol for sachets and PET bottles. Wen Adeyeye dey yarn during one session for the NAN Forum wen hold for Abuja on Sunday,she come hammer on the ban and the agreement wen the Distillers and Blenders Association of Nigeria sign. Na for the year 2018, nia NAFDAC for take ban the sale of alcoholic beverages for sachets and PET bottles wen dey smaller than 200ml for Nigeria.
IPMAN don start to dey get petrol from Dangote
Report say the Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria IPMAN don start to dey lift petrol from the Dangote Petroleum Refinery. This one dey happen after IPMAN reach agreement with the refinery last month. News people say so far, IPMAN members don lift millions of litres of petrol from the Dangote refinery wen dey for the Lekki free trade zone for Lagos. The National Publicity Secretary of IPMAN, Chinedu Ukadike wen confirm d matter during one interview with news people come talk say the lifting of petrol from the Dangote refinery start for late November.
No force your pikin do training – Mbappé
‘Project Mbappe’ don become one popular word among football parents wen love football wen go like make their children follow the footsteps of Real Madrid striker Kylian Mbappe. E no really dey surprising, becos of the extraordinary success wen the 25-year-old don achieve based on say he don win one World Cup, seven Ligue 1 titles, finish as runner-up for the Champions League, and seven Ballon d’Or nominations. However, Mbappé don warn parents say make dem no force children dey demand for training so dat dem go be the next football icon.
Magistrate court give Dele Farotimi bail
One Ekiti State Magistrate Court don grant human rights lawyer Dele Farotimi bail for one defamation case wen Afe Babalola file. The 2023 African Action Congress (AAC) presidential candidate, Omoyele Sowore, announce the development for him X handle on Monday. Sowore come talk say d court grant Farotimi N50m bail with surety for the same amount, when must provide landed property as collateral and then d court come adjourn d case till 29 January 2025.