US President Donald Trump on Monday sign one executive order wen go end wetin he call “transgender ideology” from the military, and dis move so dey mark one ogbonge step back for LGBTQ rights. During different military kind of announcements for Air Force One, Trump come still call for the development of one US equivalent of Israel Iron Dome missile defence system. The executive orders come reinstate service members wen dem sack becos dem no gree take the COVID-19 vaccine and den expand efforts to end diversity programmes within the armed forces.
I Go Tell My Lawyers To Komot Court Case Against Dele Farotimi – Afe Babalola
Di upandan wahala wey dey between Afe Babalola and lawyer Dele Farotimi wey dey like do activist work, be like wetin go soon end. Remeber say Babalola karey Farotimi go court say, book wey di activist write dey talk bad about am and Magistrate Court for Ado Ekiti to punish am but now he don change mind to komot mata from court. Na afta di Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, go visit Babalola on Sunday nite for hin house join with other traditional rulers. Wey dem dey tok nai Babalola say many pipo even foma presidents don beg am and so he nor get choice but to listen to everybodi. He say e nor get anytin wey he wan gain if Farotimi go stay for prison so him go tell him lawyers make dem komot di case from court.
EFCC Nor Wan Arrest Ezee Concept Again
As quiet fight dey go on between gospel singer, Mercy Chinwo and Music Manager, Ezekiel ThankGod Onyedikachukwu, wey everybodi know as Ezee Concept sotay dem come even use Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) put for di mata, dem don close mata for arrest. Na on Friday for Federal High Court for Lagos nai dem take cancel arrest mata against Ezee Concept afta di petition wey EFCC don already karey go meet court. Naso lawyer Bilikisu Buhari wey be EFCC lawyer tell di judge, Justice Alexander Owoeye say dem dem nor want that part again. EFCC don bin dey try to arrest Onyedikachukwu cus of say he nor use $345,000 of moni wey come out from di music well and even di songs of Chinwo dey online, she nor know how e dey waka pass. Di fight come dey hapun between di singer and manager since, wey di singer say she nor know how moni dey waka pass.
Nigeria Pipo Nuba 1 Bleaching Cream User Worldwide, Health Minister
Dem don karey first position give Nigeria for bleaching cream wey men and women dey use and di govimet don dey try to make sure say dem tok to pipo about di danger of bleaching cream to make pipo stop. For one regional awareness-raising workshop to komot lightening cosmetics products, wey Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Salako, take tok for Gabon, nai he take dey urge West African pipo to know di bad tin wey products wey get hydroquinone, mercury and other tins dey do for pipo bodi even cus cancer, skin problem and damage pesin organ. But on Wednesday for Abuja, Dr. Salako, bodi come dey pepper am as he say pipo go even see wetin dem write put for those creams, ointments, soap, pills and injections but dem nor go still hear, dem go karey dey use especially women wey wan show dem men. He come say Nigeria don dey do National Policy for Cosmetics to make sure say pipo wey dey wan use cosmetic products dey safe from all dis bad tins wey dey cus sicknes and disease for users life.
We go deal with Naira buying and selling – CBN
Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Dr. Olayemi Cardoso, don promise to tackle the buying and selling of Naira notes, wen don trun something else for the country. CBN Governor, Mr. Olayemi Cardoso make d promise for one keynote address during the inaugural Stakeholders’ Conference of the Committee of Heads of Banks Operations (CHBO) for Lagos, with the theme “Commoditization of Naira: The Way Forward.” Cardoso wen the Senior Special Adviser to the CBN Governor, Fatai Kareem represent come talk say dis buying and selling of the Naira dey pose serious threat not only to the banking sector but also to the daily lives of Nigerians when dey rely on the currency for transactions.
NYSC Batch C Camp open today
The National Youth Service Corps NYSC don confirm am say the 2024 Batch C Stream 2 Orientation Camp go officially open today, Wednesday, January 22, 2025, for across all d states for the country. The Corps share dis announcement through messages for the NYSC official X handle, #officialnyscng, on Tuesday. The statement come advise Prospective corps members (PCMs) to report to their different camps on the date wen dey for their call-up letters, with their required documents and survival packs. The NYSC come still announce the release of deployment letters for the 2023 Batch ‘C’ Stream II and say PCMs go fit access their deployment details to prepare for the service year.
SSANIP don suspend their warning strike
The Senior Staff Association of Nigerian Polytechnics don suspend the plan wen dem been get to start three-day warning strike wen suppose start today, January 22, 2025. For one statement wen the National Secretary of SSANIP, Nura Gaya sign wen he send give news people today, he say dem suspend d strike after dem meet with the Federal Ministry of Labour and Employment. The meeting wen the Minister of Labour and Employment chair involve key stakeholders, including representatives from the National Board for Technical Education, the Federal Ministry of Education, and the Federal Ministry of Labour and Employment.
Presido Tinuba Appoint Foma APC Acting Chairman As NYSC Oga
Presido Bola Tinubu don appoint nee chairman wey go head di National Governing Board of National Youth Service Corp, NYSC, in di pesin of Prince Ntufam Hillard Eta. Eta don bin di acting national chairman of All Progressives Congress (APC) for foma President Muhammadu Buhari time and na real politician to di ground. As hin don be di National Governing Board Chairman wey be di highest level for NYSC policy-making body, Eta go now put tins in place to make sure say di scheme straight pass as e dey bifor. He bin don dey complaim say some kind tins nor dey go well for di system so nor he leadership go epp bring beta opportunity for Nigerian youth wey dey serve govimet.
Warri Need New Look – Ovuozorie Macaulay
Di foma Seketary to Delta State govimet, Comrade Ovuozorie Macaulay, say make all di new govimet wey dey enta power dey always think of how to development Warri cus nai be di bubbling place of di state. Na wey di foma labour leader wey still Serve as Honourable Commisoner for Inter-Ethnic Relations and Conflict Resolution dey tok for await radio nai he take tok so. Macaulay say any investment wey govimet put for Warri e worth am cus di city don bring beta development to do whole kontri. But he nor come happy say wey foma Gov Ifeanyi Okowa give am position to work as di Director-General of Warri, Uvwie and Environs Development Agency, WUEDA, he nor fit work well cus moni nor dey to do di work, he come be like say di position na just to disgrace am, nai make am dey explain hinsef to pipo. Maculay come thank foma Govinor James Ibori as he give am di opportunity to epp bring peace for di crisis wey dey Warri that time.
President Trump must change e mind for birth citizenship – Immigration Lawyers
Immigration lawyers don karey di new Presido wey just enta obodo USA , President Donald Trump go court cus of di law wey he remove say US nor go karey dey give citizenship to children. On Monday, as Trump just enta position nai he sign say any man or woman wey come visit USA come born pikin that period dem nor go give di pikin citizenship or do pesin dey stay di kontri but nor get legal paper OYO nai go he di case of di pikin. Dis Trump order don stop di birth right law wey don dey for ages and na in one month time dem go start to follow di law. Na di tin make immigration lawyers say dem nor go sitdon allow Trump scatter dem law wey don dey for years, so Dem gada for New Hampshire on Monday evening to write di suit. But for Trump side, he say he nor get shaking say di law he don put am and naso e go be