One Councillor for Ughelli wey dey rep pipo of Evwreni Ward 8 don join di train of pipo wey die as dem dey serve for councilor seat inside Delta State for di period of nine months now. Obukoadata Aghoghofia, according to tori, dey play ball for Evwreni community wey all of a sudden he just fall for ground die instantly. Even di chairman of Ughelli North LGA l, Jaro Egbo, for Facebook confirm say Aghoghofia don truly die and naso pipo just dey send message of sorry to di family members. Bifor dis councilor die one councilor Friday Ohwoevworuemu, from Uwheru ward 16 wey dey same LGA die on April 23 afta small sickness.
Mama G Don Promise to Karey Widow and Pikin To Court For Land Mata
Actress Patience Ozokwor, aka Mama G, don say she go karey one widpw and di pikin to court cus dem dey lie for her head about land mata. One video of di widow and her dauta waka for social media say di only land wey di woman husband leave for her bifor she die nai Mama G go buy by force. Plenty pipo don dey tok about di mata bifor Mama G come out make pipo hear her side as she buy that land for 2010. Mama G say na di widow nai go meet her agent to look for pesin wey go buy land nai dem see for her but walaha start for 2024 wey she hear say di widow don go sell one part of di land. As she hear, nai she go fence di land but now di mama and di dauta dey cry say na force she take di land from dem. Patience on Tuesday come say all wetin dey hapun na just cheap blackmail to spoil her name and she nor go allow any bodi try am cus na court dem go reach.
Jaguda Boys Beat VP For Ondo Cus He Seize Phone From Student
One mama wey her pikin dey write WAEC for Complete Child Development College, Aule for Akure, Ondo State capital, nai go send jaguda boys to go beat di skool Vice Principal cus he nor allow di pikin use phone take do expo. D VP, Mr Rotifa see phone for di boy hand during exam time, nai he kolet di phone from di SS 3 student, say why he go karey phone enta exam gall dey write wey be against di law. Di next day di mama of di boy karey fight come sotay di proprietor of di skool get to give her di phone. Later that day di boy broda wey finish from di skool come still threaten di VP say he go deal with am. Investigation wey di state govimet do thru di Director of Skools, Ondo State Ministry of Education, show say afta dem close some boys don already tamer dey wait for di VP outside, nai di man dodge go report to police. Two officer come follow Mr Rotifa for motor go look for di boys, naso di jaguda drag VP from motor giving koret beating sotay he land for hospital. Fear of say di bad boys go come back Mr Rotifa nor for near hin haux again, di remaining paper wey still dey go on , do skool don put measures in place for di students and teachers to dey save, while police dey try to arrest di jaguda boys.
Tinubu don form National Credit Guarantee Company
President Bola Tinubu don establish the National Credit Guarantee Company (NCGC), with one initial capital of N100 billion. Tinubu come still approve the constitution of the NCGC board, den he come appoint Yakubu Dogara, before before speaker of the house of representatives, as chairman. When d presidency dey announce the development for one statement on Thursday, them come talk say the company na one transformative institution wen dey designed to de-risk lending and boost access to finance for micro, small, and medium enterprises (MSMEs). The NCGC still dey expected to serve small corporates, manufacturers, consumers, and large enterprises for across Nigeria.
Troops kill 60 terrorist for Borno
The troops from Operation Hadin Kai kpuff 60 terrorists for Bita for Borno state for one overnight joint land and air operation. One reliable military source when confirm this informate give the News Agency of Nigeria NAN for Maiduguri say d troops overpower d terrorists during one serious gbege around 1:09 a.m. on Friday. According to the source, the coordinated offensive wen involve troops under the 26 Task Force Brigade of Sector 1 and the Nigerian Air Force (NAF), take place after one attempted assault by the terrorists on one military position.
Gunmen Attack WAEC Students For Benue
Wetin for turn to anoda set of problem for di kontri nai police don epp push away on Thursday for one Govimet Skool.wey dey for Odugbo inside Benue State. Some men wey karey gun nai rush di skool student wey dey write dem Senior Secondary School West Africa Examination Council (WAEC) exam around 1:20 for afternoon. Tori get am say di men wey karey gun na herdsmen and naso dem dey shoot everywhere, wey make di students and teachers start to dey run forforty. Dem sha say na with di epp of 80 man Patrol Team for Benue State Civilian Joint Task Force wey dey for Odugbo nai sharply run down start to chase di gunmen, naso dem run enta bush.
NAPTIP Don Call Speed Darlington Wey Sleep With 15 Years Girl
Singer Darlington Okoye, aka Speed Darlington, wey run mouth say he sleep with one small girl for hotel, National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) don call am to come ansa mata in pesin. Na Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency nai karey di mata go put for NAPTIP ear afta Speed Darlington dey tok for Instagram Live say he sleep with one 15 years girl for hotel. Wey he dey even do di Live pipo don already dey vex for am for di word he tok and others come go dig out anoda video wey pipo dey drag am say he sleep with dem 16 years pikin. As tok don dey waka too much for Speed Darlington nai he quickly do anoda video deg beg pipo say wetin he tok na lie, he just dey use am take one promote he new song wey dey come and make pipo forgive am for wetin he don cus with him mouth. But that one nor still end mata as on Thursday nai NAPTIP confam for two pages letter say make he come dey office and if he nor come dem nor go take am easy with am.
Chelsea knack Real Betis, win UEFA conference league
Chelsea come from back knack real betis 4-1 for the EUFA conference league finals wen dem play on Wednesday night. Two goals for five minutes change the music of the game, with man-of-the-match Cole Palmer wen create both openings for Enzo Fernandez and Nicolas Jackson. Like dis, dem don become the first club to claim all four major European trophies.
Emefiele don petition appeal court ontop Abuja estate mata
Before before Central Bank of Nigeria Governor, Godwin Emefiele, don petition the Court of Appeal for Abuja to do aback turn on top one judgment wen grant the government full control of one large estate for Abuja wen contain 753 housing units. The Economic and Financial Crimes Commission before now obtain one court order to seize the estate, wen dey for the Lokogoma district of Abuja. At first, the estate been dey linked to another before before government official wen no get name but however, Emefiele, through him lawyer A.M. Kotoye, come dey talk say dem suppose involve him client for the proceedings, as d property concern am. Like dis, Emefiele don begin dey seek the Appeal Court’s reversal of the lower court ruling.
We don empower 266,737 Deltans – Gov. Sheriff
Delta State Governor, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori say him administration don empower a total of 266,737 Deltans through different social intervention and empowerment programmes for across the state. Governor Oborevwori yarn dis one wen he dey deliver the State of the State address to members of the Delta State House of Assembly for the Assembly Complex. He come talk say him administration dey deliberate, intentional, and proactive wen e come to providing a safety net for groups wen need assistance through well-targeted social protection initiatives, particularly now wen things be as e get for the country. He say dem empower the 266,737 beneficiaries through different programmes, including the Delta CARES (D-CARES) Programme, Women Empowerment and Skill Acquisition Programme (WESAP), Working Fingers Initiative, MORE Grants Scheme, MORE Biz-Up Programme, and the Widows Welfare Scheme.