The Independent National Electoral Commission (INEC) don begin complain again about one new method of vote buying. Chairmo of the commission, Mr. Mahmood Yakubu come talk say the plan na to use people wen dey sell food around polling units as collection points of cash for votes. Na yesterday nia Mr. Mahmood for take yarn dis one for the opening of one meeting with the European Union (EU) Observation Team and the ECOWAS delegation for the commission headquarters for Abuja. The commission come talk say the issue reach their ear wen dem dey yarn with stakeholders for across the six geo-political zones for Naija of recent.
I go exile 2006 – Rotimi Ameachi
Rotimi Amaechi wen be d director general of the reelection campaign of President Muhammadu Buhari talk yesterday about how he take enter 10-month exile for Ghana for d year 2006 when before before Presido Olusegun Obasanjo dey for power. Wen Amaechi dey explain wetin he pass thru, he come tackle Obasanjo for d way wen he take talk say President Muhammadu Buhari don return Naija to the “Abacha era”. He come tell Nigerians to compare the administration of the Peoples Democratic Party (PDP) to dis present administration and say make dem decide which one dey closer to Abacha government.
Opposition party dey cause wahala
Alhaji Lai Mohammed wen be d minister on top information and culture don talk say d wahala wen d opposition dey plan dey threaten the forthcoming elections. Wen Mohammed dey yarn wit news people yesterday for Abuja, he come talk say the federal government get informate say the opposition dey plan better casala wen go spread well well. The minister come talk say the opposition don decide to cause wahala because dem know say dem go surely lose.
FG don release allawee money
The federal government say dem don release N9.5 billion for the payment of scholarship allowee wen dem dey owe Nigerian students wen dey for both home and abroad up to December 2018. Na Adamu Adamu wen be d minister on top education nia drop dis tatafo during one press conference wen shele for Abuja. He come talk say the administration of President Muhammadu Buhari don already spend more than N800 million for 2018 for the payment of scholarship to students for both home and abroad.
make dem compensate victims of bombing
Femi Falana, human rights lawyer, don call on the National Human Rights Commission (NHRC) to compensate victims of the accidental bombing wen happen for Rann for Borno state. Nothing less than 120 people nia wunjor den 52 nia come denkwes for d month of January 2017 when one Nigerian air force jet by mistakenly bomb one internally displaced persons (IDP) camp for the town. For one letter wen Falana address go give the executive seceto of the commission, he dey ask for more investigation, den he come accuse the air force say dem dey try to cover up the okamuka wen happen.
275 people kpuff for road last year
Na about 393 children nia involve for accidents towards the end of the year 2018. For d release wen the Federal Road Safety Corps FRSC drop dis past weekend, dem say 29 of the children kpuff on top d matter. In total, the FRSC say 275 persons nia kpuff during the end of year special patrol for 2018
Darmian wan buy waka
Manchester United full-back Matteo Darmian go soon buy waka comot from the club and den he go come join Juventus on loan. E clear say the 29-year-old go sign for the Old Lady for £3 million and the short-term deal go fit dey permanent next summer as him contract for United go surely expire. Darmian addition go still also allow Juve defender Leonardo Spinazzola kawasaki comot for Bologna on loan.
Lottery win palava
One 27 year-old man wen him name na Emmanuel Okachi don lose one eye even as he dey find spiritual powers so dat he go fit dey win lottery games wen we dey popularly dey call ‘Baba Ijebu.’ Okachi go meet one babalawo for Ishiagu village, near Ogwashi-Uku for Delta State to help am so dat he go fit dey see lucky numbers. Osita Uzoka wen be friend of Okachi come clear the News Agency of Nigeria yesterday for Ogwashi-Uku say na on Jan. 12, 2019 nia d matter for take happen.
Obasanjo Blast Buhari
Before before Presido Olusegun Obasanjo blast President Muhammadu Buhari yesterday den he come say Buhari administration na d same tin as the era of the late before before Head of state, Gen. Sani Abacha. Obasanjo yarn dis one for him 16-page statement wen he title Points for concern and action, wen he release give news people for Abeokuta. Obasanjo come talk say dis administration dey use security agencies take dey gbege anybody wen dey attack dem and opponents of the government and say dem still dey cause wahala for our democracy .
Minimum wage still under consultations
The Federal Government don set to present the N30,000 new National Minimum Wage proposal give the National Economic Council by tomorrow for more consultations. This one nia be d koko wen dem agree on for one extraordinary meeting wen the Federal Executive Council hold wen end yesterday night for Abuja. Na State governors, the Central Bank of Nigeria and some major Ministries and Departments and Agencies of government nia make up the NEC. The Central Bank of Nigeria CBN say dem receive information say 36.6 million Nigerians no get access to financial services. For one statement wen d bank release give news people, dem say dem go host one conference for national financial inclusion stakeholders for Naija. The conference wen dey aim to facilitate the 80% financial inclusion target, dey scheduled to hold on Thursday, January 17 and Friday, January 18.