Di Govinor wey just komot from Delta State, Ifeanyi Okowa don land for Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) afta dem arrest am say he chop di state moni put for pocket. Dem arrest Okowa cus of N1.3 trillion wey be di 13 percent derivation fund wey dey come from federal govimet to all state wey dey produce oil from 2015-2023. As e be dem say Okowa use he office as Govinor take dey tiff di moni, use am buy property and other tins keep under bed bifor dem catch am on Monday. . Even tokpesin Dele Oyewale, say dem arrest Okowa when he come dem office for Port Harcourt but he nor gree tok more than that.
Family Provoke Afta Police Give N100k To settle Death Of Woman For Nasarawa
Di families of Ashenenye wey dey stay for Nasarawa State, dey vex as dem pikin wey be 35 years die for police hand, then later police bring N100k make dem take do burial. Patience Akla Ashenenye dey on top okada with her teree months pikin wey one Hilux van from govimet house jam dem for October 21, 2024, for back of Ta’al Conference Hotel, close to School of Health for Lafia. As di accident hapun nai dem rush Ashenenye, her pikin and di okada man, Tasiu Mohammed to Federal University of Lafia Teaching Hospital, but afta 20 minutes nai di woman die. Di broda of Mrs Patience, George Akube wey dey tok to Foundation for Investigative Journalism, FIJ, say two days afta di sista die, dem dey do wake keep when two DPO come say dem come greet di family with N100k to take epp dem. Akube say dem reject di moni even his sista inlaw cus na justice nai dem want for dem own come join di small teree months boy wey still dey hospital dey take treatment for leg wey break. Even di State Police Command PRO, Ramhan Nansel, say really di CP Umar Shehu send pipo to meet di family and give dem moni to epp reduce stress and still go pay for di other two wey dey hospital. But he come say even di police officer wey jam dem still go police clinic for Lafia for treatment cus shock enta he bodi but afta dem discharge am nai he go greet di family. Say that one nor still stop di CO not to give justice for di death of Patience.
Sickle Cell Pipo Get Chance To Survive Afta Operation For Lagos
No be small sumtin nai di Lagos University Teaching Hospital, LUTH, don do to give hope to pipo wey get sickle cell disease afta one bone marrow transplant wey dem do for two patient wey get di disease. Di two na one mature pesin and anoda one wey be children dokitor nai dem bin admit did di Sickle Cell Foundation, Marrow Transplant Center for Lagos. Di tin wey dis transplant don do for di pipo life nor be small as na even beta name don gum Nigeria for West Africa side to fit do dis kind operation. Two of di patient don go house but di hospital still dey observe dem and as e be, na like 127 pipo nai dem wait for di Sickle Cell Foundation of Nigeria, SCFN, wey colabo with LUTH to make sure say pipo wey get di sickness fit come out well again.
National Association of Seadogs visit communities for Udu wit medical care
Relief come for families and people of Egini and other communities for Udu Local Government Area of Delta State, as the team of the National Association of Seadogs (NAS) visit the community to give free public healthcare services based on their routine medical outreach for communities across Naija. Hundreds of people for Egini and other Communities wen dey near, women, children, youths and te en old people gather for Egini Primary Healthcare Centre for the town to take advantage of the free medical services wen come their doorstep. The free healthcare service wen the NAS run dey happen for dis critical period when public medical services for Nigeria don get k leg becos of d back to back strike wen the National Association of Resident Doctors (NARD) dey fire down with, meanwhile the Chairman of Udu LGA Hon Vincent Oyibode come hail the initiative say dem finish work. NAS Chief Operating Officer wen dem dey still dey call the Pyrates Confraternity, Doctor Kenechukwu Eneli come talk say the outreach na one of the humanitarian services of the association, and say the medical service na for the primary level of healthcare. Meanwhile some of the people wen this good thing touch come thank the association of seadogs as dem come to d rescue of these communities unto say na opportunity for them to get access to medical attention.
Presido Tinubu go swear in new ministers today
President Bola Tinubu go swear in seven new ministers today after he recently reshuffle him cabinet. Na Bayo Onanuga, special adviser on information and strategy to the president nia confirm the development on Sunday. Meanwhile, the ceremony dey expected to take place for the council chamber of the state house, Abuja. Sunday Dare, the special adviser on public communication and orientation to President Bola Ahmed Tinubu don talk say “the label” wen dey ring say the administration dey favour south-west wen w come to appointing heads of security agencies no follow. For one post for hin X account on Sunday, the presidential aide share one table wen dey made up of the heads of 20 security agencies and the region of the country wen dem come from. Whereas, he do dis one becos of wetin people dey talk as Tinubu take appoint Olufemi Oloyede as the acting chief of army staff (COAS).
#EndBadGovernance protest: Human rights group,others don condemn treason charge
The National Human Rights Commission, NHRC, don condemn the treason charge wen the Nigeria Police Force enter against smallie dem wen dem accuse say take part for the recent EndBadGovernance protest wen hold for across the country. The rights body, through their Executive Secretary, Mr. Tony Ojukwu, SAN, say d smallie dem wen dem carry go court becos of d report say dem dey make attempt to overthrow the government of President Bola Tinubu, “clearly dey against national, regional and international laws.” Even as dem dey hail the Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Prince Lateef Fagbemi, SAN, for d way wen he take tell the police to transfer the case-file to him office for review, the Commission come blast the Federal High Court for Abuja for imposing wetin dem describe as “harsh bail condition” wen go dey impossible for the accused teenagers to fulfill.
Troway the charges against #EndBadGovernance protesters – Falana
Femi Falana, human rights lawyer don tell one federal high court for Abuja to dismiss d charges wen dey against 76 #EndBadGovernance protesters wen dem charge go court for treason. No be small yawa nia gas for one Abuja federal high court on Friday after some smallie dem wen dey among the 76 protesters wen dem charge go court, collapse wen dem dey wait to appear for court. Wen Falana come dey yarn on Sunday, he come talk say in line with Section 18 (3) (a) (b) (c) of the 1999 Constitution, Section 15 of the Child’s Rights Act, Section 2 of the Universal Basic Education Act, and Article 17 of the African Charter, them no suppose try s underaged defendants.
No Buy Black & white Invisible Nivea Roll-on, E No Good — NAFDAC
Pipo wey dey bring products, distributors, and even sellers nai dem don dey advise make dem stop to bring one particular brand of Nivea Roll-on with bar code 42299882 wey dem do for Germany, say e get wetin fit condemn human being life. Na National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, nai say one 50ml batch of Nivea Black & White Invisible 48-hour Roll-on nor good at all for human being to use. For notice wey di agency release on Thursday, nai say di product with batch nuba 93529610 nor dey good to use for African weather cus European Union Rapid Alert System for Dangerous non-food products in Brussels nai first give di update. Naso NAFDAC start to kolet all di ones wey don already dey for market cus di Nivea product get 2-(4-tert-Butylbenzyl) propionaldehyde, one kind chemical wey go fit make man and woman nor for born pikin, or make pikin wey pesin born get one kind bad problem then even cause burn or skin irritation for some pipo.
Come Tok How You Take Give Us N15M — EFCC Tell Bobrisky
Popular man wey dey behave like woman, Idris Okuneye aka Bobrisky, nai don reach Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) hand for kwestun and ansa as tortoise name wey nor dey komot from story. Na for Murtala Mohammed Airport nai EFCC take catch Bobrisky yesterday, Thursday nite as he wan run from Nigeria go Amsterdam for obodo UK, nai dem drag am komot from di areoplane. Wetin insiders from di Commission tok be say as dem catch Bobrisky yesterday for Lagos dem don fly am to Abuja make he go ansa case wey Senate and EFCC call am to ansa concerning di N15M wey he use take bribe some EFCC officials to take remove money laundering case for he head. Bifor now di Director of Public Affairs, EFCC, Wilson Uwajaren, nai say Bobrisky nor suppose dey run upandan make he come prove di case of N15M wey he give EFCC cus if dem find out say na lie, that one na anoda new gbege.
Senators Suspend Meeting Again Till November
Di Upper Chamber on Thursday say dem dey go for anoda recess till November 19, 2024. Na wey dem dey for dem plenary nai dem take decide to go for immediate suspension so that di lawmakers for gi resin some matas to cool off. Remember say e never tay wey di senators come back from dem holiday from July to September 17 but 17 pass dem nor resume till September 24.