As Presido Bola Tinubu don change name of Ministry of Niger Delta Development to Ministry for Regional Development and come even change di ministers, House of Representatives come say dem go meet am to change he mind back. Na PDP member Oboku Oforji from Bayelsa State nai first bring di mata up and everybodi come folow am but small time mata come change as di House say other tins don take over di event. Di Speaker of di House, Abbas Tajudeen, say he meet President Tinubu last week nai Presido give assurance say South-South Development Commission Bill na still same tin as e go take care of di specific issues wey dey concern Niger Delta Region; so make dem kukuma forget di mata. All di lawmakers come follow gree then even di House Leader, Julius Ihonvbere, APC, Edo, come say as dem convert d ministry that one nor mean say e go reduce Niger Delta Region but na only just to make am wide so that development go dey touch everywhere and other region too.
More Than 10 Pipo Don Die For Ibadan Building Collapse
One building don fall for Jegede Olorunsogo, wey near Ona Ara LGA for Oyo, Ibadan, and na more than 10 pipo nai don die then 7 nai dem don bring out alive. Tori get am say na early mormor nai di building take fall cus Fire Service Agency say na around 2 for nite nai dem take get urgent call say di building don fall. Rescue team still dey on ground dey try bring pipo out from di collapse building according to di General Manager of Oyo State Fire Service, Rev. Akinyemi Akinyinka.
Nollywood actor, Charles Olumo don die
Veteran Nollywood Actor, Abdulsalam Sanyaolu, wen every know as Charles Olumo and Agbako, don die. Pa Agbako die for 101 years. Bolaji Amusan, the presido of Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria, TAMPAN nai announce am for him Instagram page on Thursday. He post say “#tampanglobal dey announce say Pa Charles Olumo Sanyaolu wen evri know as AGBAKO don die. We go share the informate about him burial later. Good night father, 5/02/1923 to 31/10/2024.” Jide Kosoko confirm this gist too when he write say “Good night ooo, Baba Charles. a.k.a Agbako, 101 years, ba wasa ba. R I P.”
No More Final Year Celebration Afta Exams — Ebonyi State University
As e don turn norm for final students to always dey celebrate their graduation, buy drinks and do party, Ebonyi State University Management don say that habit dem nor want an again for dem skool. Na for statement wey di Registrar of di university, Jeremiah Nwamgbo, sign for Abakaliki nai dem take put am say dem don ban final year graduation celebration kpatakpata. Dem say those celebration don cause many wahala for di skool sotay e dey disturb pipo wey dey learn and even cause security problem. Di Vice-Chancellor of di university come join tell di Presido of Students Union Govimet to shout di ban wella so that any pesin wey dem punish nor go say e nor hear.
Court Tell CBN Make Dem Nor Give Rivers Moni
Federal High Court for Abuja don give order say all di monthly allocation from Central Bank of Nigeria wey dey go meet Rivers State, make dem stop am cus e get kleg. On Wednesday wey Justice Joyce Abdulmalik dey give di jorjimet nai he take say di 2024 budget wey Govinor Siminalayi Fubara send to Rivers House of Assembly nor just folow di normal Nigeria constitution. Di judge say how four-member panel go sitdon and approve allocations since January, but dem nor go sitdon allow that kind tin Kwatinue again. Nai di judge say make CBN, Hakantant General of di Federation, Zenith, and Access Bank make dem nor allow di State Govinor take moni from di Revenue and di kontri Federation hakant.
EFCC Arrest 4 Bank Hackers For Abuja
Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don hold four men wey dey do wayo enta pipo bank hakant and even withdrawal without dem knowing afta infomat give tip about di men woruwuru ways. Di leader of di group nai be Chima Anthony Nwigwe, then Effiong Victor Emmanuel, Damian Ali folow join and Mohammed Bello Mahmud, nai come be di Managing Director of Downstone Ultimate Limited. Di work wey dis men dey do, na to dry hack bank systems, put some kind funny tins for database, do transfer and even withdrawal moni thru different platforms. Wetin EFCC tokpesin, Dele Oyewale, come say in Tuesday be say, di men dey with dem and afta investigation na to enta court.
INEC Make Una Comot Ondo REC Oga, Protesters
Some protest pipo don line up for Independent National Electoral Commission, INEC, headkwata for Abuja, say dem nor want Mrs. Oluwatoyin Babalola to be di Resident Electoral Commissioner for Ondo State again cus dem nor trust her. Di pipo karey different kind of card write say wetin hapun for Edo State during di Govinorship election, dem nor want that kind play for Ondo State even though say dem nor get problem with di REC. Bifor dem dey come out for protest, Govinor Seyi Makinde of Oyo State tok some days ago say di kind relationship wey di REC get with APC, go make tins hard for di state election cus di REC oga fit run wetin hapun for Edo for Ondo. Wey INEC National Commissioner, Major General Modibbo Alkali (retd), come dey folow di pipo tok, he say make dem nor worry say di Commission go resin di mata wey dem karey come give dem.
Politician Wey Slap Driver, Don Come Out To Beg
Alex Ikwechegh di House of Representative member wey from Abia State, don get many lamblaster from pipo afata he slap one Bolt driver, Abuwatseya, wey come deliver package, di driver come tell am to come outside to pick am na there he take vex, even say he go komot di driver from dis life and he nor get who wan epp am. Laslas afta plenty tok and blasting, di politician don come out to beg di driver and Nigeria make dem nor vex for di kind behavior wey he display, as w nor good for pesin wey dey for public eye and cus of di behavior he go use am take dey train pipo on how to dey behave wey dem dey vex. Ikwechegh say he nor like wetin he do Abuwatseya, di constituency wey he dey rep, and even di general public. He come still thank Nigeria police as dem sharply enta di mata to make sure say nor politician yeye anybodi no mata who dem be.
Judikay – God Is
Naija Gospel singer wen get koret talent don drop one new praise tune wen she call “God Is”. Wetin God be to you? For the song Judikay dey clear every wetin baba God be based on Him many titles and doings wen dey make every hail am. Judikay don release other songs like More Than Gold, You Too Much, and many other songs. If you be lover of gospel song wen get vibes, this song go bless you wella.
Kidnaper Kill Cameroon Mayor of Bamenda
One of Cameroon politician wey be mayor for Bamenda don die as dem see her deadi bodi for Nchoubuh junction with blood everywhere. Di mayor na Joko Frida and na she be be di second deputy mayor of Bamenda 2. Dem say she dey come back from President Paul Biya’s documentary film projection from town, on October 26 but kidnaper tiff her for Savana Street wey her house dey. Family pipo say dem don karey her deadi bodi go Bamenda Regional Hospital make dem go do rest. Di way di woman die never clear but pipo dey suspect say di attack come from separatist group.