Professor Abdullah Yussuf, the Chief Medical Director of the University of Ilorin Teaching Hospital, don tell both men and women to practice d habit of regular cancer screenings, say men still dey at risk of developing breast cancer. Yussuf yarn dis one today for Ilorin during one programme on ‘Walk for Breast Cancer Awareness’, wen dem organise as part of the activities to take mark Breast Cancer Awareness Month for the University of Ilorin Teaching Hospital. Wen d CMD wen Bilyaminu Abayomi, the Chairman of the Medical Advisory Committee for UITH represent come dey yarn for one interview wen he get with news people during the programme, he come explain say breast cancer na disease where cancer cells dey form for the tissues of the breast.
Papa Of Nine Kill Sef For Jeddo Cus Of Wife
On Monday, October 7, 2024, wey pipo dey say new week don start nor be so for Mr Charles wey dey stay for Jeddo community for Okpe LGA, as he karey otapiapia drink die. Dis man na pesin wey don born 9 children and na vigilante nai be he work for Jeddo but pipo say dem hear wey hin and di wife dey quarrel and Charles come dey beg di wife make she nor park leave am but di wife nor gree. Tins come get kleg afta Charles drink otapiapia for he house for Jeddo finish nai he karey hesef go he in-law place for Ugbokodo, come die there. As pipo dey surprise wetin hapun, wey dem dey check am, na only di otapiapia empty bottle dem see for he pocket.
JUST IN: Wahala For Rivers State Afta Opening Of LGA
Anoda gbege don burst out for Rivers State for Ahoada East secretariat wey be di LGA of Edison Ehie wey be di Chief of Staff to Govinor Siminalayi Fubara. Di problem na sake of say some pipo say lie lie di new chairman nor go enta di office to sitdon do work. Know say afta teree months wey dem clos LGA secretariats for Rivers state na today Monday nai Inspector General of Police, Kayode Egbetokun tell di CP for di state to komot di ban. But day never even finish, na koko-tasatasa from police nai don porchu pipo go hide head for one cus of say jaguda one turn di tin to anoda tin.
Police Don Komot Form Rivers State LGAs Wey Close Down Bifor
To follow tins di right way di 23 LGA wey police bin lock for Rivers State, di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, don say make dem open di Secretariat. Nai di State Commissioner of Police, Bala Mustapha, thru hin di state tokpesin, Grace Iringe-Koko, bring statement on Monday hours afta Govinor Siminalayi Fubura don swear in di LG chairmen wey pipo vote on Saturday. Na for July nai police take close di 23 local govimet headkwata for Rivers state afta gbege come out say di chairmen don stay pass dem time and nor wan komot. Since di election don come and go l, e dey right now for di policemen to komot from di premises as dem bin dey there as hold di place down bifor.
Di Resin I Make My Pikin First Lady For Akwa-Ibom, Gov Umo Eno
As di First Lady for Akwa-Ibom State, Mrs Patience Umo Eno just die all of a sudden di husband wey be Govinor Umo Eno don give di First Lady work to dem first dauta Mrs Helen Obareki. Pipo start to chop mouth for di mata why Govinor Eno go karey First Lady position give he pikin wey di deputy govinor wife dey alive. But di Govinor don explain di resin wey make am do wetin hin do. He say first of all na Senior Special Assistant, SSA and Coordinator of di First Lady Office nai he give Mrs Helen Obareki so that she fit continue with di work wey her mama bin dey do bifor she die. Pastor Eno come use example from bible of Peter tok, say hin know say normally dem nor dey appoint First Ladies but with di way tins come be na Mrs Obareki nai dey close to do mama and sabi tins wey di mama don put in place , so e do dey good make she epp complete am so that di projects nor go die. So as Mrs Obareki dey take di role for office make no bodi think say ma politics mata but na just base on di experiences wey she get and know about get mama project and intiatives.
Woman Buy New Born Baby For N2m, Keke Man Save Baby
Police don arrest one Lauretta Akomen for Warri, Delta State, afta she go buy baby of teree days from one native place wey dem take dey born for Port Harcourt Rivers State. For October 1, 2024, nai one keke man wey four women hire to karey dem for Warri, start to hear how di women dey tok about tins wey concern di baby wey dem karey. As di driver hear am, afta two of di women come down nai di keke man change location karey di other two women drop for Ekpan police station. Wey police come dey ask di woman, nai Akomen say dem give her some medicine make she take for di native clinic afta some time she come be like who get belle, na dem come tell her when di baby go ready make she come kolet am. According to SP Bright Edafe, Police Public Relations Officer for Delta State Command, he tok on Friday say na N2m nai di woman take buy do pikin and dem don dey do investigation afta e finish na straight to court.
VIO Stop To Seize Pipo Motor For Road, Court
Federal High Court for Abuja don tell Directorate of Road Traffic Services aka Vehicle Inspection Office, make dem quickly stop to dey tie pipo motor for ground. Na Justice Evelyn Maha nai give di jorjimet afta Abubakar Marshal, wey be human rights activist and public interest lawyer karey di case go court. Court say as VIO dey karey heap moni and other tins for pipo wey dey move motor for road, e nor good as e nor even follow di law. So for October 2, 2024 nai Justice Maha, agree with di lawyer say make VIO officials nor ever resin am to stop, seize or even kolet moni from any motor pesin hand for road.
Call Yahaha Bello Name for Newspaper, Court Order EFCC
As di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don dey try since to serve foma govinor of Kogi State, Yahaya Bello, fresh charges of N110 billion and dem nor dey fit, nai Federal High Court tell dem to summon Bello. Na Justice Maryanne Anenih nai give di order make EFCC put Bello mata for newspaper afta Bello suppose show for court today and he nor still come. Di judge come still say make dem karey di public summon still out for everywhere for di court make e clear for e eye.
Make Only We Fight Boko Haram To Avoid Problem — Defence Chief
Make una make military get beta guns to use instead of to bring outside military to epp fight. Na wetin General Christopher Musa, the Chief of Defence Staff, tok as he dey reply wetin Senator Ali Ndume tok. Ndume bin say make dem go outside bring military pesim wey go epp fight Boko Haram especially cus of di pipo wey die for di new attack for Ngoshe inside Borno State. But for Arise TV show nai Musa take say e nor go make sense say dem wan bring military from outside cus if dem look di example of Mali and Iran di result nor end well laslas. He say one problem wey dem dey get na informants wey dey send info to Boko Haram about dem way but with how colabo dey with American and European kontri for training tins go soon dey alright. Musa come say make Nigerians pipo get patience small with military cus dem dey try dem best and e even beta pass as e be bifor.
Obey Court Order, Protest Pipo Tell Govinor Simi
As October 5 don dey reach wey River State go use take do Local Govimet Election, some pipo don gada go Rivers State Peoples Democratic Party secretariat in the for Port Harcourt say lie lie di election nor go hold. Bifor now Federal High Court bin don tell Rivers State Independent Electoral Commission, say make dem suspend that LGA election. But as di day don dey near nai protest pipo gada PDP building for di express road say dem must obey wetin court tok. Dem karey card board paper dey sing and shout say make di Govinor and RSIEC folow di order given but police don dey there to make sure say tins nor pass be careful cus hold up don already dey di busy road.