Presido Bola Tinubu don give go ahead to di North East Development Commission, NEDC, say make dem bring electric motor for North so that transportation problem go reduce there. Di commission say dem wam still put 5KVA or 10KVA solar grid, wey go epp supply gas for di region as dem dey bring di electric motor and keke. Dis information na from di mouth of General Paul Tarfa, wey be Chairman of di Commission nai yarn am afta meeting with VP Kashim Shettima for Presidential Villa on Wednesday.
Presido Don Japa For Yearly Vacation To Obodo UK
Presido Bola Ahmed Tinubu today range he load wey he wan karey go stay for obodo UK for two weeks base on say na so he dey do every year. Na di Special Adviser to the Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga nai announce tok di mata. Di statement say make pipo nor think say na just chop and sleep nai Presido go dey do for UK, cus na work he go still dey work and even dey think and make move on how he administration go fit beta di life of kontri men dem.
Hold Your Dog and Cat If You Nor Wan Enta Prison For Six Months — Oyo Govimet
With di Dog Law of 2019 wey don already bin dey for Oyo State, pipo wey get dogs and cats di state govimet don tell dem to dey always give dem animal injection make dem nor dey give human being rabies. Na through di Commisoner for Agriculture and Rural Development, Olaleye Olasunkanmi, nai di govimet take tok so for Ibadan, say make pipo dey give vaccine to dem cat and dog. Dem say any pesin wey get cat or dog and never go visit veterinary clinic make he do so fast bifor govimet hand go touch am as do spread of disease from animals to human being too much. Nai Olasunkanmi come still say dem nor wan see any dog or cat dey waka anyhow for street without di owner by di side and any pesin wey go against dis 2019 law na N250,000 e go pay, or go six months for jail or if e too much na di two punishment di pesin go face.
We Nor Attack Any Protest Pesin For Abuja, Police
Police command for Abuja say make world pipo nor resin di video wey dey waka for social media say dem use tear gas chase October 1 pipo wey dey protest for FCT. Di video show na na like 50 pesin wey dey protest near Utako market nai police enta use tear gas troway for dem. But laslas di PPRO of FCT command, Josephine Adeh, say nor be true as na info dem get say some jaguda wan come tiff and scatter pipo store, so instead of dem to sitdon and nor do anytin nai dem take act sharply so make pipo nor resin di video.
Police Close Rivers State Electoral Commission
Rivers State Independent Electoral Commission, RSIEC, building nai di State Police Command don close base on do order wey Federal High Court. Di court don bin say make dem pause electoral tins wey concern LGA election for di state even as dem dey prepare for October 5 wey di election go take place. But today heavy policemen don mount for di front of di building cus court say make nor security pesin join bodi for di election or even give out security during di election.
Food Go Soon Yakpa, Make Una Nor Worry – Presido Tinubu
As Nigeria dey celebrate dis year 64th Independence Day celebration, Presido Bola Tinubu say dem go do 30-day National Youth conference, so that all di pain wey dey face di kontri dem go rub mind togeda. Na for di State House nai Presido take dey give di assurance for hin independence day speech say tins wey dey affect Nigeria youth like work, skool, and other tins go be tin of di past. He come still say high cost of food and living wey lilo dey complain about go soon end cus nor be only Nigeria nai di tin dey touch but laslas everybodi go dey okay. About di youth Confab, Presido come tok say dem go pick some pipo wey go stand as to represent dem.
Govimet Say No Big Celebration For Independence Day
As October 1 independence day celebration dey come and hunger wey dey kpokpo di whole kontri, Govimet don say dem nor go do big celebration while youths say dem go enta street protest. Di year na di second time wey di administration of Presido Bola Tinubu say dem nor wan do big celebration for October first as shege banza dey tear for pipo eye even with di N70k new minimum wage increase. Wetin Senator George Akume, Secretary to Govimet of di Federation, he say why Presido say make dem nor tear gbedu for di October independence, na cus ginger dey beat pipo and di govimet dey sorry for di ordinary kontri man. Even as govimet don say dem nor wan do big party for di Independence Day celebration, some activists wey dem bodi nor for rest for di mata say dem go karey protest enta street cus tins don too much and don pass garri.
Police Invite University Don To Ansa Mata Ontop Terrorism Charge For Uwheru
University Don, Patrick Muoboghare, nai Delta state police command dey accuse of terrorism, gun running cartel, hard drug selling plus other yamayama tins. Patrick na di Presido General of Uwheru Kingdom for Ughelli North LGA, and police under X-Squad Unit say maje he and some community leaders like Chief Macpherson Igbedi, Mr Obukohwo Ekpevwru, karey demsef report to dem headkwata for Asaba. Na by 11’Oclock dis morning nai di letter say make Muoboghare wey be foma Commissioner for Higher Education, reach di office with di other suspect wey police don already dey investigate bifor. Assistant Commissioner of Police, Lucky Adagbon wey dey in charge of di X-Squad Unit nai sign di letter. Even one pesin inside di community confam di letter and say di way di problem dey smell e be like na from di gbege wey dey between di traditional ruler for Uwheru Kingdom and some of di leaders for di community.
First Lady Of Akwa-Ibom State, Mrs Patience Umo Eno Don Die
Cry don full Akwa-Ibom pipo face as tori just drop say Mrs Patience Umo Eno wey di wife of Govinor Umo Eno don die. Na early morning today Friday nai dem say di First Lady die for hospital afta sickness and her family members dey around her wey she die peacefully. Di information of her death na di State Commissioner of Information, Ini Ememobong, nai bring release am. Dem no call di name of di hospital but na on 26 September, 2024 she die. The family dey cry and say make pipo pray with dem. Even as dem dey cry dem still want to cry privately and any information about di burial process dem go let pipo know.
I Dey Think To Kill Mysef— Bobrisky Cry Out
Popular boy wey dey dress like woman Idris Okuneye aka Bobrisky say di N15m wey dem tok say he go pay EFCC dey make head turn. For he Facebook page nai Bobrisky take say since dem born am he never think to kill hesef once but as he dey now, wetin he dey resin na how to die. He say human being just wicked and na how to bring pipo down nai dem dey think about cus you nor like di pesin. Even pictures and videos for Instagram he don delete all. Wetin he write be say he nor need any bodi to pity am cus na only he mama and papa wey don die fit pity am. But if you dey think say friends go fight for you, then you don lost. Know say na Vincent Martins Otse aka VeryDarkMan nai drag Bobrisky come outside say he pay huge moni to EFCC to drop moni laundering charges against am and even call Falz and he papa name, Femi Falana say dem try to get am presidential pardon from prison. Cus of wetin VDM bring out nai make even di House of Rep say dem don set up ad-hoc committee to investigate EFCC and Nigerian Prison Service to know di truth.