As fuel price don go up for Akwa-Ibom state sotay e dey drag price with one paint of Garri say one liter pipo dey buy am for N2,500, Nigeria Labour Congress (NLC) don tell all civil servants say dem go enta strike and nor know when e go over. Di strike so go start today Thursday, September 26, 2024 and other problem wey join for di strike na say Independent Petroleum Marketers Association (IPMAN), and Petroleum Tanker Drivers (PTDs), don bin get small issue sotay dem tell pipo to close deme filling station. Govinor of di state, Pastor Umo Eno don bin say hin go do sumtin about di rise for pump price and punish any bodi wey dey sell above normal price but NLC say dem nor like di way di govinor dey behave like ogbolo towards di mata. For statement wey NLC bring out nai dem say di Govinor don fail to take beta decision on behalf of di pipo and e go even beta make he set task force to check do mata of say army go seize tankers wey don already load with fuel.
EFCC Sama New Case Of N110b Against Yahaya Bello
New 16 count charges nai Federal Govimet don samakwe give di foma Govinor of Kogi State, Yahaya Bello, and di moni reach N110 billion. Know saye bifor dis new case EFCC bin don charge Bello N80.2 billion for moni laundering wey he tiff and karey govimet cash take dey chop life for Nigeria and Dubai with he broda/sista children wey Ali Bello, Dauda Sulimam, and Abdusalam Hudu. Dis new charges of N110 billion wey EFCC karey go Federal High Court for Abuja dem say na base on criminal breach if trust. While oga Bello on he own bim don drag EFCC to Supreme Court say dem dey declare am wanted like say hin na tiff.
Actor Plan Justice Protest To Lagos Assembly Cus Of Mohbad death
Dem don dey call Youths and pipo wey di tin dey pain for bodi to come out come do peaceful protest on Monday September 30 to get justice for Ilerioluwa Aloba wey do die. Na Nigeria film actor Yomi Fabiyi wey be still human right pesin nai dey drum dis protest from Instagram. He say na Lagos State House of Assembly nai dem go waka go cus do way pipo wey dem hand dey for Mohbad death dey spend millions to make sure say dem cover evidence about di poor boy death nor good and Lagos State Govimet get set up committee to investigate. Do actor say normally for di house wey Mohbad dey state get CCTV camera, wetin dey stop police to go check di camera nai he never know. Fabiyi day make Lagos rep dem do sumtin so that pipo wey dey keep kwayet nor go come karey law put for hand as di case nor dey funny again.
Galatasaray don sign Super Falcons defender, Demehin
Turkey club Galatasaray don announce say dem don sign Super Falcons defender Oluwatosin Demehin. Demehin na 22 years and she bin dey for French club Stade de Reims before she dey enter Galatasaray with one year contract so. She play beta part wen she dey Stade de Reims wen make dem con take 4th position for the French D1 Arkema for last season. With two years for France ,now she don ready to carry her skill enter Turkey. For Galatasaray, na No. 4 jersey she go wear. Demehin bin play for Sunshine Stars and Rivers United wen she dey club for Naija.
River Benue: Water don reach flood level – NIHSA
THE Nigeria Hydrological Service Agency, NIHSA release updates dis past weekend on rising water levels of River Benue, say the water level don already dey reach flood levels as of Thursday, Friday, and Saturday. NIHSA give warning say e dey very important for states and local governments to begin dey activate preventive measures to help reduce the impact from the expected flood. NIHSA come still talk say dem go continue to dey give Nigerians update on the flood wen dem go experience, but say dem need to do the needful before the worst go happen.
Edo Election: Okpebholo don win,obaseki tell him supporters to calm down
The Independent National Electoral Commission, INEC don declare Monday Okpebholo, candidate of the All Progressives Congress (APC) as the winner of the Edo state governorship election. Na Farouk Adamu, INEC returning officer nia announce the results for Benin City, the Edo state capital, on Sunday. Okpebholo wen be senator win the election with 291,667 votes to beat him closest rival, Asue Ighodalo of the Peoples Democratic Party (PDP), when get 247,274 votes while Olumide Akpata, candidate of the Labour Party (LP), come carry distant third with 22, 763 votes Meanwhile, the Governor of Edo State, Godwin Obaseki don tell him party and supporters to dey calm and make dem no break the law after the Independent National Electoral Commission (INEC) declare the All Progressives Congress candidate, Senator Monday Okpebohlo as d winner of the Edo State governorship Election. Godwin Obaseki yarn this one for one live Nation Broadcast for Benin City. He come talk say ojoro full the Edo State Election.He talk say the result of the September 21st Governorship election for the State don weaken the spirit of many Edo people. Ontop this matter, one odon for the All Progressives Congress for Edo State, Chief Charles Idahosa don blast Obaseki say make he stop to dey blame institutions wen dey there to make sure say the election for the State dey free and fair. Idahosa come talk say dis one na the first time wen Governor Godwin Obaseki dey contest election alone without anybody to support am even for him own party.
We go release money for traders – Comr. Agbateyiniro
The Chairman of Warri South Local Government Area, Comr. Weyinmi Isaac Agbateyiniro, don talk say him administration go release fund this week for traders wen don successfully go tru the koret financial literacy and business-related programmes wen the Council organize so dat the traders go fit effectively manage the loan wen dem promise all the markets for Warri South. Comr. Agbateyiniro yarn dis one for the Warri South Council Main Secretariat, when he dey swear in the new Secretary to Warri South Local Government, Mr. Emmanuel Nunu and the first Supervisor for Innovation and Sports Development for the Council, Chief Butler Igbigbi. The Warri South Local Government Chief Executive come list ongoing construction of two places where dem take dey kill malu and cold rooms for Pessu Market, reconstruction of the section of Igbudu Market wen burn, empowerment of 450 People With Disabilities, PWDs, advance plans to give bursary to 1,000 students wen dey for tertiary institutions, monthly payment for 275 senior citizens above the age of 65 and the reconstruction of Omadino/ObodoLink Road, as key major achievements of him administration within the first 65 days for Office. Wen the Secretary to Warri South Local Government, Mr. Emmanuel Nunu come dey responding, he come assure the Warri South Council Boss, say dem go work with am with him Amazing Grace Agenda.
Soldiers arrest over 100 yahoo boys for Effurun
Military personnel from 3 Battalion Nigerian Army Barracks for the popular Army Estate, Effurun for Uvwie, Delta State don arrest nothing less than one hundred youths wen dem dey suspect to be internet fraudsters. Them say dem arrest d suspects after dem receive intelligence reports den dem come discover say one HK (Yahoo training) School dey operate for within the estate premises. HK wen be “Hustle Kingdom” na school wen dem take dey train people wen wan dey do internet wayo wayo. Sources wen know about the development clear news people say dem arrest about 90 suspects on Saturday early mor mor while another dem come arrest another set of about 50 late on Saturday after dem raid the estate. Meanwhile, the military authorities for the 3 Battalion Nigerian Army Barracks Effurun don handover the suspects give the police for Ekpan for Uvwie for prosecution after proper profiling.
Edo Election: Make sure say d election go well,Peter Obi tell INEC and security piple
Peter Obi, presidential candidate of the Labour Party (LP) for the 2023 election, don tell the Independent National Electoral Commission INEC and security agencies to make sure say d Edo governorship election wen go hold dis Saturday, Sept. 21 dey free, fair and credible. Obi wen make the call for the grand finale rally for Olumide Akpata, LP candidate for the Edo Governorship election on Wednesday for Benin come talk say the people of the state go gbege against any attempt by political parties to rig the election. He come blast d state governors wen dey most times dey push their responsibilities dey give the Federal Government, meanwhile na their citizens dey suffer am.
NECO don release SSCE result
National Exam council, NECO don release the SSCE result of 2024 and na 60.55 per cent nai dem say get at least five credits with Maths and English. Na the Registrar,Prof. Dantani Ibrahim Wushishi yarn this one wen e dey yarn with journalist for NECO headqwatas ,Minna,Niger state on Thursday. Prof. Wushishi con yarn say na 1,367,736 piple nai write the exam and 702,112 na male, 665,624 na females. “The number of piple wen get five credit go up with Maths and English na 828,284, that is 60.55%. The number of piple wen get five credit go up with or without Maths and English na 1,147,597 and na 83.90%