Delta State Govo, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, dey spin Swedish investors make dem make use of di opportunity wey dem get to take do beta investment for Delta State as di place get enough natural resources. Na wey di Swedish Ambassador to Nigeria, Annika Hahn-Englund, with her pipo come visit Govinor Oborevwori for Govimet House on Tuesday for Asaba nai he take tok so. Oborevwori tell dem sag enough oil and gas dey do state and if dem invest for di state dem go gain am as di two nites wey dem sleep for di state notin hapun to dem. He come dey use sweet words dey tortori di ears of di Sweden pipo, say airport dey for Asaba, Osubi/Warri and Escravos then places like Kwale free trade zone, Koko free trade zone and the Ogwashi-Uku Agro Industrial Park na places wey git benefit too.
No Bodi Fit Komot Me From Sit, Tinubu Warn
Case wey Stanley Okonmah file against President Tinubu and na lawyer Olukoya Ogungbeje nai karey am to Federal High Court say dem wan tell National Assembly to komot President Bola Tinubu for di role he play for di 2024 #Endbadgovernace protest, others don dey challenge am. Na team of lawyers wey Sanusi Musa, SAN, Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Prince Lateef Fagbemi, SAN, and President Tinubu come say di case nor get any stand and no bodi right dey under ground. President Tinubu and AGF say di pesin wey bring case come court just dey fight for pipo wey nor get face and dem nor even tok anytin like say govimet go against dem right but di man karey mata for head like who dey hawk. Govimet say for di protest dem send security pipo to make citizens dey safe make jaguda boys nor go take over di process. Di case na Justice James Omotosho.dey jorjimet am but on Monday, dem come karey am go March 4 so that di lawyer wey dey represent Stanley Okonmah, go fit ansa kwestun wey President Tinubu and AGF dey ask.
M23 Rebels Say Dem No Wan Fight For Goma DRC Again
M23 rebel group wey di kontri of Rwanda dey back to fight Democratic Republic of Congo for di eastern city of Goma say dem nor wan fight again cus of human being sake. Many pipo nai nor get where to stay again since di fight for Goma start and di place na one of di place wey get beta mineral resources bifor dem come annonce on Monday say dem nor wan fight again and di Congolese govimet never talk about am. On Monday nai U.N. tokpesin Stéphane Dujarric tok about how tins dey go for Congo and how health problem don dey rise. According wetin UN refugee agency report tok since di fight start for 2025, more than 400,000 pipo nai no get haux again, 900 don die and 2,880 nai don wound with G7 nations and EU dey condemn why Rwanda go dey enta anoda pesin kontri. But afta di announcement wey di M23 rebels do, di Congolese govimet never put mouth for di mouth.
Killer Kill Teree Children, Put Dem For Freezer
One craze wey dem never know who di pesin be don go kill teree children wey dem papa and mama leave for haux on Saturday for Nnewchi, Nnewi, Anambra State, come put di deadi bodi for freezer. Di children wey dey do man server work for church na The children, 9 years Ejezie Chikaima Davina, 7 years Ejezie Chinziterem Dominica, and 5 years Ejezie Chimdilim David. Dem mama wey be nurse and dey do lecturer work too, nai leave di children fkd haux go write exam on Saturday February 1, 2025, but as she come dem haux door open for ground and normally do children dey lock door if dem dey go play. Na do papa of di children Ejezie Udochukwu Samuel, wey dey work for Irrua, Edo State, nai karey di mata come outside for post about wetin hapun to dem as family. He say according to do wife wey call am on Saturday, say she start to find do children sotay she find dem reach church but nor see dem, until pipo come dey find enta fridge na there dem see di teree children deadi bodi. Police Dom put bodi for di mata as di Police Public Relations Officer for Anambra, SP Tochukwu Ikenga, say dem don start investigation and even karey am to SCID cus di CP say dem must find who kill di children. But small insight wey dem get be say, do pesin kill di children bifor e put dem for di freezer cus food wey dem dey chop just dey for ground.
Pipo Congratulate Tems As She Win 2025 Grammy Award
Singer Temilade Openiyi wey everybodi know as Tems nai don win di 2015 edition of Grammy Award wey dem so on Sunday. Di song wey di Tems take tear everywhere na di “Love me jeje” single and na wetin dust Burna Boy, Chris Brown & Davido, Asake, Yemi Alade, join with plenty odas. As di singer don win di Best African Music Performance naso different pipo dey congratulate her as e nor easy. Even sef Peter Obi foma Govinor of Anambra State don throwaway salute for her and odas, say e nor easy as all of dem dey make Nigeria proud so tay dem karey shoulder like who get boil for armpit.
Naija Police save Ebonyi girl from ritualist
The Federal Capital Territory Police Command don rescue one young woman from one suspected armed robber and ritualist. Na the FCT Police Public Relations Officer, SP Josephine Adeh nia confirm the jerk for inside one statement for X on Sunday. According to the statement, the matter so happen for one hotel for the Wuse district of Abuja, where dem for take see day the guy don tie 25-year-old Promise Eze from Ebonyi State join one small chair, den he come cover her mouth with plaster. Na so she dey unconscious by d time when officers reach d place on January 31, 2025, after dem receive call from one of d hotel staff. Them come rush d victim go d Wuse District Hospital, where she for take regain her consciousness.
We don dey get fuel from Warri and PH refinery – PETROAN
THE Petroleum Products Retail Outlet Owners Association of Nigeria, PETROAN, say their members don start to dey lift petrol from the Port Harcourt and Warri refineries. Otota for the association, Joseph Obele, said the Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL – come talk say d refineries dey operate and say dem dey supply them the product. For one statement on Saturday, he come talk say “PETROAN members don begin dey load petroleum products, including Kerosene, AGO and fuel. Obele come talk say these refineries wen don begin dey work don make d competition increase and say e dey expected to drive down petroleum prices.
We don dey pay 2023/2024 students Bursary – DSTG
Delta State Government don announce say dem don begin dey pay d 2023/2024 Students Special Assistance Scheme (Bursary Award) to qualified Deltans for higher institutions for across the country. The Executive Seceto for d Delta State Bursary and Scholarship Board, Dr. Godfrey Enita wen drop dis update for inside one statement for Asaba on Saturday, come talk say thDelta State Government don announce say dem don begin dey pay d 2023/2024 Students Special Assistance Scheme (Bursary Award) to qualified Deltans for higher institutions for across the country.e payment go start on February 3, 2025. Even as Enita dey hail Governor Sheriff Oborevwori for the approval, he come talk say na 32,028 students nia go benefit from the bursary scheme.
Na development I go dey attract come – Edafe Emakpor
The Member wen dey represent Uvwie Constituency and Minority Leader of the Delta State House of Assembly, Honourable Edafe Emakpor don talk say He go continue to dey attract development to him constituency through proper legislature. Emakpor yarn dis one wen he go visit Alegbo Primary School for Effurun, Uvwie local government area of d state. The state lawmaker come present money give the school authority to take provide new school uniforms for students wen their uniforms don tear. Honourable Edafe Emakpor come talk say na him passion to see young learners study for better environment nia dey make am dey visit schools for him constituency to get first hand knowledge of their needs for immediate attention by the appropriate authorities.
Introduce whistle-blowing for project mata -Govinor Sheriff
The Govinor of Delta State, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, don talk say make dem introduce whistle-blowing so dem fit check poor projects delivery for the state. Governor Oborevwori, when make the call during one interactive meeting with Permanent Secretaries, Directors and Heads of Ministries, Departments and Agencies (MDAs) for d Government House, Asaba, come thank the civil servants for their loyalty, support, commitment and dedication to duty. He come talk say the meeting wen be the third for the series since he enter office, come become necessary becos of d reports wen dey play say some civil servants dey collabo with contractors dey play the state jogba through poor projects wen dem do. The Governor, come talk say he don suspend two engineers becos dem certify projects wen never complete for payment, and dis one na even as he talk say the decision dey necessary to serve as lesson to others.