+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Wadume Don Come Out From Prison

No be small gbedu for di pipo of Ibbi town for Taraba State as dem welcome dem Hamisu Bala aka Wadume from prison.

Na both old, young, women and children nai rush go di river side wey dem use Wadume pass take enta hin village on Sunday.

According to Musa Garba wey dey stay for di village, hin say pipo say dem giver don come back as dem happy to see am dey waka for di village bifor he come enta he hass.

Na for year 2019 nai all di wahala start afta di  Intelligence Response Team wey foma Deputy Commissioner of Polic, Abba kyari team go arrest Wadume.

As dem dey go for August 18 that year, naso some wen wey weka sojas uniform just jump come out from Bush, karey Wadume komot from di IRT team of IGP squad hand.

Tori get am say di sojas wey dey for Battalion 93 for Ibbi-Takum road wey Tijiani Balarabe lead nai free Wadume.

Teree policemen and two ordinary pipo nai die wey di sojas dey free Wadume while five police wound ontop.

Laslas police come still arrest Wadume for one of he hass wey he  just build for Kaduna.

Wetin prison pipo now tolk be say, dem free Wadume from from Abuja Kuje prison cus he don finish he jail term.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM