+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NDLEA Catch Man For Airport With 80 Wraps Of Cocaine

National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don catch one man wey dey travel through Murtula Muhammed International Airport for Ikeja with 80 wraps of cocaine.

Na on Sunday nai NDLEA say dem see one man wey wan fly to India with Qatar Airways and he name na Carr Bismark with Liberian international passport.

But afta dem come karey di man go scan am nai dem get to know say he real name na Freeman Charles Ogbonna and he come dey do one kind.

Wetin di tokpesin of NDLEA, Femi Babafemi tok be say wey dem dey ask di suspect kwestun dem come dey see say he nor dey comfortable again and dem even give am sumtin wey nor go make am shit.

Bifor you know Ogbonna don dey do like who wan vomit, naso vomit and shit start togeda for four days, he bring out 80 wraps of cocaine and one na 889 grams wey he swallow enta belle.

Ogbonna say na for one hotel wey dey Ipodo for Ikeja nai dem take five an di drug swallow afta hin family pesin introduce am to di business and dem promise to pay am N300,000 if he got deliver di goods for India.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM