+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rwanda Marks 30 Years Anniversary of Pipo Wey Die For 1994

On Sunday nai Rwanda fight between di Hutus and Tutsis reach 30 years for di fight wey hapun for July 1994 and pass 800,000 pipo nai die.

From dis week di kontri flag go deg fly half to remember di pipo wey die, dem nor play any music for radio, or even for public place.

For TV nothing like say dem wan show anytin apart from wetin concern di 1994 killing.

To see put am for every bodi bodi to know how di fight bad reach wey dey for 100 days President Paul Kagame come lite fire to take remember di pipo wey die for Kigali Genocide Memorial, where dem take bury more than 250,000 pesin.

As di army band dey play sad song from dem band, Kegame and comme karey decorations put for di pipo wey die grave with African head of states and foreign personnel wey dey to witness.

Rwandans go later karey demsef go d kontri capital wey Kegame go tok to dem and dem go come still do candle lite for di dead.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM