+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Kill Man As E Nor Gree Give E Dauta To Dem For Marriage

Bandits wey dey for Kwalfada village for Tsafe LGA inside Zamfara State don kill one man cus he nor gree give he dauta to one of dem men.

Wetin one Mallam Rabo wey dey stay for di village tok be say, one of di bandits men go tell one girl say he wan marry her but di papa nor gree.

As di papa nor gree for di bandit, he come karey di girl marry give anoda pesin for di village.

Rabo say, “Afta dem don do di marriage finish, nai bandits enta village kill di girl papa.

“Dem come tell di husband to divorce di girl so that dem own bandit member fit marry di girl.

“Dem say if di husband nor gree leave di wife dem go kill am.

“With fear nai di man sharply leave di girl, then di bandits come karey her marry dem man wey get eye for di girl, before dem take her enta bush.

Rabo say no be small tin bandits dey use dem eye take dey see for di village and security nor dey anywhere for dem.

He come still say na just few weeks ago nai di bandits tell di villagers to pay N4m as levy.

[Punch/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM